Police arrest suspected ‘serial killer’ afta dem see plenty deadi bodi for Kenya dumpsite

Di dumpsite wey dem find di deadbodi dem

AFP
Di dumpsite wey dem find di deadbodi dem

Kenya police don arrest one man wey dem call “serial killer” as e dey suspected say im kill nine women troway dia bodi for one rubbish dump.

Police tok say Jomaisi Khalisia, 33, say im don allegedly kill 42 women since 2022, wey include im own wife.

Dem arrest di suspect as e bin dey bar dey watch Euro 2024 final.

Pipo shock and vex all ova Kenya since dem find di bodi pieces dem on Friday for di capital of Nairobi.

Mohamed Amin wey be di oga of di Directorate of Criminal Investigations (DCI) say, “e confess say im lure, kill and troway 42 female bodies for di dumping site, we dem kill between 2022 to as recently as Thursday”.

E tok say afta di arrest, di suspect carry di officers go iim house wey dey about 100m from di crime scene.

Oga Amin say dem bin find important evidence for di suspect house wey include 10 phones, one laptop, one machete, identity cards and women clothes.

Dem bin find di machete wey dem “believe say na im e use cut di victims”, and nine bags like di ones wey dem use troway di bodi.

Since Friday, police don block di dumpsite wey dem find di deadbodies wey don decompose differently.

According to police, di victims bin dey between di ages of 18 and 30.

Police say dem still dey interrogate di suspect to find out why im kill pipo and e go show for court on Tuesday.

Kenya police watchdog bin tok bifor say dem dey investigate weda police get hand for di crimes sake of say di dumpsite dey close to di police station.

Di Independent Police Oversight Authority tok say, “widespread accusations of police involvement for unlawful arrests and kidnaps” mean say dem dey do dia own investigation to show weda di killings get any police connection.

Kenya Police don dey arrest more and more serial killers in recent years.

One suspected Kenyan cult leader, Paul Mackenzie bin dey arrested for April 2023, afta dem find ova 400 deadibodi wey include pikin own for mass graves, wey most of dem bin get signs of starvation.

E and 29 odas bin collect charge for February 2024 say dem kill 191 pipo.

Survivors and di victims family say Paul Mackenzie bin tell im followers make dem fast so dem go fit “go see Jesus”.

For 2021, mob beat and kill 20 year old Masten Wanjala, wey bin escape police custody afta im confess say e bin kill 10 young boys in five years.

E bin also confess say im drug dem and drink some of dem blood.

E go pretend say im be football coach come lure im victims to hidden areas, wia e go attack dem and e carry out di attacks for Nairobi and for eastern and western Kenya.

Source