EndSARS protests: [What happen in Lagos today?] Lagos close down schools

Lagos State Government don direct all pupils/students inside public and private schools to stay at home following di tensionwey di #EndSARS protests don cause, according to reports.

Commissioner for Education, Mrs Folasade Adefisayo, wey issue di orde, say di safety of di pupils/students, parents and all staff working in schools dey important “at dis critical period.”

Madam Adefisayo tell BBC Pidgin say na wen dem see say tins don return to normal na im dem go fit reopen schools.

Earlier on Monday, some schools bin tell parents not to bring dia pikin dem dem come school on Tuesday sake of wetin happun for Lagos, BBC Pidgin find out.

Tori be say sake of di #EndSARS protest, many school pikin dem bin no fit go school early while odas no fit return home sake of safety reason.