Crystal Palace vs Man City: Sergio Aguero and Ferran Torres goals push Man City close to Premier League crown

Manchester City celebrate afta dem score against Crystal Palace

EPA

Manchester City fit win di Premier League title on Sunday after two goals in di space of 83 seconds help dem win stubborn Crystal Palace.

City go secure a third title in four seasons if second-placed Manchester United lose for home against Liverpool.

After scrappy first half for Selhurst Park, Sergio Aguero thumped City ahead with clinical finish before Ferran Torres score from low shot.

That end di resistance of Palace, wey dey 13th place.

Roy Hodgson side get chances for di first half through Christian Benteke, wey flicked im header wide and bin get close-range shot wey City keeper Ederson block.

But once City make their breakthrough when Aguero smash high into di net, plus another goal quickly follow by Torres neat finish, di result no come dey in doubt.

Now di question na when, not if, Guardiola side go dey crowned champions once again after dem bin see Liverpool take their crown last season.

Sergio Aguero

PA Media
Sergio Aguero, wey never score for Selhurst Park, become di 12th player to score for 30 or more different stadiums for Premier League

City round off wonderful week

As far as weeks for world of football dey go, City don enjoy one wey fit no dey even more perfect.

Starting on Sunday when dem win di Carabao Cup final against Tottenham, and e continue on Wednesday with di impressive victory over Paris St-Germain for Champions League semi-final first leg, Guardiola squad perfectly round off a pivotal week.

With di second leg wey dey come up on Tuesday, Guardiola shuffle e team as im make eight changes and dem initially no show any rhythm against a Palace side wey look solid.

After Jesus see di ref rule out im close-range finish for offside, City go into di break wit no shot on target for di first half for di first time in 21 matches.

Patience and second-half improvement wey serve as di key to City win for Paris prove imsef again.

Guardiola demeanour bin dey buoyant and relaxed after im secure vital win, afta im don dey able to rest key players and seemingly avoid picking up any injuries.

Now im go switch focus to complete di job against PSG on Tuesday and take City into their first Champions League final.