South Africa in eight charts bifor dia elections

Woman wey dey wia south Africa flag

AFP

South Africa wey be one of di richest and most influential kontris for Africa dey go vote on 29 May, even though kontri pipo dey worry about unemployment, high crime rates and power outage.

Here for charts na di big issues for di election – di seventh wey don happun since di democratic era start for 1994.

ANC support for general elections since 1994

BBC

If opinion polls dey correct, den di election dey come wit new phase for di kontri politics.

Di African National Congress (ANC) don be di most powerful political force since dem lead di fight against di white minority goment and di racist legal system wey dem bin all apartheid successfully.

Dem win di kontri first democratic elections for 1994 and don dey power since den.

But dia share for elections don dey drop since 2004 wey be di highest share of 70% wey dem get.

Surveys show say e fit drop lower dan 50% for di first time wey go make di party to enta some kain collabo.

South Africa GDP per capita

BBC

One of di tins wey don reduce di ANC support na di state of di economy.

If you combine di last 50 years togeda, South Africas on average don dey richer. Poverty levels don reduce and generally pipo don dey beta housing and health care.

But form 2011, average incomes don dey reduce, wey make pipo to dey reason dia sapa and cause accusations say di party of di goment don run di economy street.

Recently sha na external factors like di coronavírus pandemic and di global increase in prices don dey deal wit South Africa.

Top 10 most unequal kontris for di world

BBC

If you check out wetin di averages dey tok, dat one no fit tell you di full tori of di kontri as di money no dey reach evri body equally.

If you use di measure wey dem dey call di Gini coefficient wey dey calculate di kain income different groups of families dey make, South Africa na di most unequal kontri ofr world.

For example, di richest 20% of di population na dem dey make almost 70% of di money. And di poorest 40% of South Africans just dey share 7% of di nation money.

South Africa unemployment rate

BBC

One of di main tins wey dey cause di inequality and wetin dey show di biggest impact of di economic problems na inside di unemployment rate you go see am. World Bank say na di highest for di world.

E dey struggle to recover di way e bin hide during di pandemic. As at now na almost one third of South Africans dey find work, or no see work do.

Di economy neva grow reach di level wey e go fit provide for all di new pipo wey dey enta job market.

Share of youth wey no dey for education, employment or training

BBC

Na young pipo unemployment don nack pass. Ova 44% of pipo wey dey between 15 to 34, no get education, training or employment.

Like plenti African kontris, South Africa get young population as most of di 62 million pipo for di kontri dey less dan 35 years old.

One UN report from last year call di lack of work say na “ticking time bomb”, say e fit cause political kasala for future.

Crime per 100,000 pipo for South Africa

BBC

For dia election manifestos, di political parties promise say dem go handle di high levels of crime wey di kontri don dey face for many years.

Di numbers show say di number of attacks don drop small in di last decade but di rates of robbery, rape and murder still dey as e dey.

In di last three months of 2023, evri 20 minutes for South Africa dem dey kill one pesin on average. In di same time period, dem don dey rape ova 130 pipo daily.

President Cyril Ramaphosa don call dis level of violence say na war wey dem dey do against women but im party don enta hot water ova di way dem dey handle di wahala.

Days of load shedding for South Africa

BBC

South Africans now dey get rest small from di regular power cuts wey di kontri don dey face for recent years.

Di planned outages, wey dem call, load shedding, don affect pipo life and damage economic growth.

Poor maintenance, ageing infrastructure, corruption and mismanagement na wetin kontri pipo dey use blame di state-owned power company Eskom for di failures.

Di origin of migrants to South Africa for 2023

BBC

Around 3%, dat is to say about 2.4 million of di pipo wey dey stay for South Africa na immigrants dem be.

Even wit di kontri economic palace, e still dey pull pipo for di region and Africa as a whole come dia side.

But dem dey accuse foreigners wey no even plenti like dat in di grand scheme of tins say na dem dey take jobs from locals and say na dem dey cause di high levels of crime. Waves of xenophobic kasala don target many pipo inside di kontri.

Earlier dis month, Human Rights Watch tok say dem dey use foreigners as scapegoats for di election campaign wey fit cause more xenophobic kasala.

Source