Mr Ibu dey get better and dem no cut im two legs – Family

Di family of Nigerian popular comic actor John Okafor wey pipo sabi well-well as Mr Ibu, don clear di tori wey dey fly up and down on top mata of im health.

On Saturday, 16 December, tori bin spread say di actor health dey deteriorate plus doctors don amputate im second leg.

Some local media bin report say di President of di Actors Guild of Nigeria (AGN), Emeka Rollas tell tori pipo say Mr Ibu don undergo anoda leg amputation and e no fit tok.

However one member of im family Valentine Okafor for one post on di actor Instagram page don set di record straight on Mr Ibu health.

Ms Okafor post say dem no amputate Mr Ibu second leg but na dat first leg wey dem cut doctors bin work on again.

“First we go like clear am say dem no amputate our daddy on both legs but only one. Di first amputation no completely correct im health predicament so di doctors gatz go ahead to amputate di same leg further to make sure we no lose am”. Ms Okafor write for di post.

Di family also clear am say di sickness wey dey worry di actor no be diabetes but e get “constant clotting of blood for im leg (diseased blood vessels)” plus oda health challenges wey dey pose as risk to im life.

Ms Okafor also add say di only reason why di family neva fly Mr Ibu comot di kontri na because di doctors don tag am “Not Fit to Fly”. she say dis tag don make am extremely impossible to get am out of di kontri for advanced treatment as no airline go fly him.

“Daddy currently dey admitted for one of di biggest and best hospital we get for Nigeria as of today and di hospital don provide am plenty professionals.”

Di family assure Mr Ibu fans say e dey get better and make dem disregard unconfirmed reports concerning im health.

Na on 6 November, Mr Ibu family bin reveal say dem cut di actor leg afta e undergo seven surgeries.

Doctors no get choice but to cut di leg “to keep am alive”, di family bin tok for one statement on im Instagram page dat time.

Di 62-year-old popular Nigerian actor don feature for plenty Nollywood feems wey include Keziah, 9 Wives and Mr Ibu in London.

No be di first time wey di actor sickness go enta public space be dis, for March 2022, Mr Ibu bin announce say e dey down wit food poisoning.

Born John Okafor, Mr Ibu na actor, stand-up comedian and MC from Enugu state, Southeast Nigeria.

E don act hundreds of Nollywood movies both for Nigeria and abroad.

Pipo sabi am for how im dey take keep im face wen e wan make pesin laff.

Im dey also dance and crack jokes.

Source