Di four African kontries Africans fit enta visa-free and wetin you need to know

Rwanda don join list of kontris wey go allow visa-free travel for pipo wey be citizens of oda African kontris.

As one of di African kontris wey pipo like to dey visit, Rwanda introduce visa-free travel for all African visitors.

Di president of di kontri Paul Kagame announce for Thursday say Africans no go pay anything before dem enta di kontri.

Im add say anybody wey dey travel from any African kontris to enta Rwanda go enjoy visa-free travel.

Dis new introduction go make Rwanda di number four kontri for Africa wey don make visa free for African visitors.

“Make no mistake about am. Any African fit get into a plane to dey come Rwanda whenever dem wish and dem no go pay anything to enter our kontri,” President Kagame tok.

Kagame add say dis new move na to capitalise on di tourism industry wey don begin dey grow across Africa. Rwanda na one very ogbonge kontri wey tourist like to dey visit sake of dia landscape and attractions.

Di kontri dey partner wit big clubs like Arsenal and Bayern Munich as dia way to promote di kontri as better place for tourist attraction.

Kenya don also announce similar plan to drop visa demands for Africans from 2024.

African kontries wey be visa free

For 2022, di Africa Visa Openness Index, AVOI release say Benin, Seychelles and di Gambia na di only African kontries wey dey allow visitors from all oda African nations visa-free.

For di report, diz three kontries bin rank first, second and third, respectively. But now, Rwanda don join di list wit dia new announcement.

Although for dis report, e show say West Africa kontries account for nine (9) of di top 20 performing kontris in terms of visa free travels and dem be: Benin, di Gambia, Senegal, Ghana, Nigeria, Guinea Bissau, Cape Verde, Togo and Sierra Leone.

Senegal rank fourth, Ghana score fifth while Nigeria rank seventh for African kontries with visa openness

While four (4) of di 20 most visa-open kontries dey for Southern Africa and dem be: Madagascar, Mauritius, Mozambique and Namibia. based on di report.

Six of di 20 most visa-open kontries dey for East Africa and dem be: Comoros, Rwanda, Seychelles, Somalia, Tanzania and Uganda.

But for now, Rwanda don finally join Seychelles, The Gambia and Benin, wey be di only African kontris wey African visitors no need visa to enta.

Source