Sierra Leone election 2023 winner: Julius Madaa Bio declared winner of presidential poll by ECSL

Julius Madaa Bio

Getty Images

Sierra Leone President Julius Madaa Bio don dey declared winner of di kontri presidential election to lead for a second term.

Di Electoral Commission for Sierra Leone, ECSL, announce say Bio win 1,566,932 – 56.17% of di votes cast.

Di presidential election happun on 24 June, 2023 before dem announce di result today.

Data wey show how Maada Bio win

BBC

Di winner of di election suppose secure 55% of di valid votes cast, otherwise run-off go dey between di top two candidates two weeks afta di announcement of di results.

13 candidates bin contest for di presidential seat, including di incumbent president, Julius Maada Bio, wey wan go for second term in office.

Meanwhile di European Union observers bin criticise di electoral commission for a lack of transparency, and note say incidents of violence happun for some regions during di vote on Saturday.

Di opposition All Peoples’ Congress, APC, bin complain about di conduct of di election and di electoral commission.

On Sunday, Mr Kamara say dem fire live ammunition inside im party headquarters as e bin dey hold news conference. Reports say dem dey fear for di life of one woman wey wound.

Mr Kamara also allege ballot stuffing and voter suppression for some parts of di kontri.

While supporters of both main parties don dey accused say dem attack opponents.

Accusations of election irregularities were also being thrown on Saturday, after Mr Kamara alleged ballot stuffing and voter suppression in some parts of the country.

However, di electoral body bin insist inside press conference, say dem get mechanisms in place to ensure a fair vote.

Reports say Saturday vote witness a high turnout, with voters wey tell BBC say di process dey smooth despite say polling stations open hours late for many areas.

Di election happun as di kontri dey face a troubled economy, di rising cost of living, and concerns about national unity.

Di voters go to di polls to choosing a president, MPs and councillors for di West African kontri fifth election since di civil war end for 2002.

Dat 11-year conflict take an estimated 50,000 lives, but since den, di kontri don get a tradition of largely peaceful, free and credible elections, according to Marcella Samba Sesay, chairperson of di NGO National Elections Watch.

Map wey show how Maada Bio win

Julius Madaa Bio

BBC

Dem born Julius Bio on di 12th of May 1964.

Im Place of birth be Sogbini Chiefdom for di Bon District.

Dem swear in Julius Maada Bio as di president of Sierra Leone on di 12th of May 2018.

Dat na afta e defeat di former ruling All People’s Congress (APC) Party candidate Samura Kamara for di April 2018 run-off election.

Bio na experienced politician, e bin loose 2012 presidential election against President Ernest Bai Koroma of APC wia e gbab second for di poll.

E briefly lead di kontri for 1996 as chairman of di National Provisional Ruling Council (NPRC).

Dat na wen e comot Captain Valentine Strasser, wey bin carry out coup for 1992.

Strasser bin seize kontrol from Joseph Maidu Momoh All People’s Congress (APC) goment.

As Sierra Leone leader, President Bio don navigate economy palava like di one di Covid-19 pandemic bin cause, plenti years of hardship wey one fall in di price of commodity exports and Ebola outbreak cause.

Julius Bio get military background, as im na retired Brigadier General.

Julius Maada Bio get ogbonge career, e bin don dey in charge of different national office so e get experience wella. E be ex-Minister of Information, Broadcasting and Culture.

Also, President Maada Bio na former Principal Liaison Officer.

E bin dey in charge of Finance, Foreign Affairs, Information, Youth, Sports and Social Mobilization for di council of State Secretaries.

E gbab dat appointment for July 1992, and dem reappoint am on 2 December 1992.

Ex-Vice-Chairman and Chief Secretary of State (di position na equal of Prime Minister), Supreme Council of State from July 1993 to January 1996.

Julius Bio also be Ex-Chairman of di National Provisional Ruling Council [Head of State] from January 1996, e comot di post for March 1996.

Di incumbent President Julius Maada Bio bi di Presidential candidate for Sierra Leone People’s Party for di 7 March 2018 election.

E win di election for second round of di election and dem Swear am in for April 2018 as Commander-in-Chief of di Armed Forces.

Julius Bio get one wife and four pikins.