BBNaija evictions today: Tega, Boma, Michael, Peace chop eviction from Big Brother Naija show

Tega, Boma, Michael and Peace don dey evicted from di Big Brother Naija show.

Tega be di first to comot on Sunday tonight for inside wetin organizers of di Big Brother Naija ‘Shine Ya Eye’ reality TV show bin don tok say go be ‘King-size Eviction’.

Tega eviction dey followed by Michael, Peace and lastly Boma for wetin Biggie say na quadruple eviction show.

All di housemates bin dey up for possible eviction on Sunday except, Jackie B and Jay Paul wey be di Heads of House.

Jakie B and Jaypaul win oda housemates last week Monday to find di most keys and finish dia task for di weekly Head of House game on 30 August wey biggie introduce with a twist.

Di last HOH game bin come wit a twist as Biggie announce earlier say dem go get two winners and e tag am ‘The double Heads of House’.

Out of di 15 housemates wey bin dey up for di possible eviction on Sunday; At di end, Saga, Saskay, Emmanuel, Nini, Cross, Angel, WhiteMoney, Liquorose, Pere, Queen and Yousef bin safe.

Last week Sunday, three housemates – Maria, Sammie and JMK chop eviction for a triple eviction show.

How fans vote

Di voting chart reveal say Tega, Peace, Boma, Michael, Saga and Nini dey di bottom six.

Out of di four pipo Biggie evict on Sunday night, Boma and Tega own spark di most reactions becos of dia ‘entanglement’ for inside di show.

Her closeness and ‘kissing’ escapades with Boma bin cause a lot of toks outside di house sake of say she be married woman.

Tega however tell Ebuka afta dem evict her say she bin dey put up a ‘show’ and hope say di viewers enjoy am.

Meanwhile, Boma tell Ebuka wen e ask am say im and Tega bin just dey ‘cool’.