WAEC result checker: How to check result 2020 on phone, SMS and online

Nigerian student dey write Waec

Getty Images

West Africa Examination Council Board, WAEC release di results of di West African senior secondary certificate examination (WASSCE) on Monday 2 November 2020.

For statement wey di oga of di Nigeria Waec Head office, Patrick Areghan bin give, e say 1,538,445 candidates na dem write di exams for Nigeria.

E bin also announce say di serial number and pin wey di candidates suppose use to find dia results dey di Smart Identity Card wey dem use to write di exams.

Oga Patrick say di certificate for pipo wey dia result don dey fully processed go comot in three months time (90 days).

Dem bin postpone am from di earlier date wey dem bin announce wey be 28 October afta violence spread across Nigeria afta hoodlums hijack di peaceful End SARS protests.

So how you fit check your result?

Na two different ways you fit check, online ontop WAEC website and ontop your phone.

To check online

  • Log enta di WAEC result checking portal, www.waecdirect.com
  • Put your examination number and pin wey dey your Smartcard (wey you get before you sit for di exams)
  • Fill in di exam year, and di type of examination (for dis case na privatecandidate results)
  • And wait, make di result page load.

Tok-tok pesin for Waec, Demianus Ojijeogu tell BBC Pidgin say, you fit also get your results via SMS.

How to check on phone

Plenti short codes dey ground wey you fit use check results according to di network di candidate dey use.

Di format na to send message with dis format, WAEC*ExamNo*PIN*ExamYear, send to 32327.

Read also: See wetin go happun to candidates wey WAEC seize dia result