Isa Funtua, Abba Kyari, Zulaihat Buhari, death of close friends and relatives to President Buhari

Apart from one of im closest friends Samaila Isa Funtua wey die on Monday, President Muhammadu Buhari of Nigeria don lose some oda very close pipo to am to di cold hands of death in recent past.

Dis na some of dem:

Zulaihat Adamu Hardo

President Buhari on several occasions don tok about di death of im mother for December 1988 as one of di most painful tins wey don happun for im life because after di death of im father at di age of four, na im mother raise am as a single parent.

Zulaihat na fulani woman from Daura town for Katsina northwest Nigeria and e no dey clear wen she marry di presido papa but some say di marriage happun for 1930s.

“Some pipo say my mother saved me from detention because di military goment wey overthrow me detain me for three years and na after my mother die dem release me.” President Buhari tok for one event.

Zulaihat (Nee) Buhari

At di time wey dis death happun for 2012, some pipo say e take long before President Buhari regain himself because of di pain.

Zulaihat na di presido first daughter and e name her after im mother e come give her nickname Nee to show how much e love her.

She die for one private hospital for Kaduna just two days after she born pikin from Sickle Cell Anaemia.

Mallam Adamu Hardo

For pipo wey no know, dis na pesin wey born President Buhari – yes president Buhari papa and e die wen di two time presido be four years old for dia Daura home town inside Katsina northwest Nigeria.

Mallam Adamu Hardo na fulani chief for Daura area and apart from Buhari wey be im 23rd child e get oda children from different wives wey e get.

Di presido don tok about di pain of not growing up with his father for many public discussions wey im do.

Abba Kyari

President Buhari former chief of staff die three months ago from coronavirus (and e be one of di former General’s closest friends.

Kyari na di first senior goment pesin to die of covid 19 for Nigeria and na very prominent pesin for goment.

President Buhari’s relationship with Kyari as di president tok am after im death dates back decades ago and dem maintain am till death.

E first appoint Kyari chief of staff on August 27 2015 and re-appoint again after e win re-election to show how much e like am.

Samaila Isa Funtua.

Dem born both President Muhammadu Buhari and Samaila for di same year (1942) inside di same Katsina state northwest Nigeria and dia friendship start from childhood till dem grow.

Na pesin wey alongside Mamman Daura dey always dey with President Buhari for im personal moments.

Samaila apart from being close friend to President Buhari na also in law as im son Abubakar Isa Funtua dey marry Safinatu Buhari.

President Buhari for statement on Monday say e receive di news of Samaila death with deep sadness because na im longtime friend and associate.