Roe v Wade: Politico leak suggest Justice Alito want SCOTUS to overturn abortion rights

Roe v Wade: Politico leak suggest Justice Alito want SCOTUS to overturn abortion rights

Reuters

US Supreme Court fit dey about to overturn di nationwide legal right to abortion, leaked report suggest.

Dis na according to one leaked draft opinion wey don make activists to enta streets of Washington.

Politico, tori pipo, reports say Justice Samuel Alito don write di document say di landmark 1973 Roe v Wade decision dey “badly wrong”.

If Politico reports dey verified, di leaking of di document fit be wetin never happun before inside di US Supreme Court modern history.

Di justices dey expected to issue dia ruling on di case by early July.

Neither di Supreme Court or di White House wish to comment on di leak on Monday night.

“Roe dey egregiously (badly) wrong from di start,” di draft opinion reportedly tok.

Di opinion add say: “Time don reach to obey di Constitution and return di issue of abortion to di pipo elected representatives.”

Justice Alito also reportedly write say Roe v Wade reasoning bin dey “exceptionally weak” and e don get “damaging consequences”.

“Di conclusion wey dey difficult to notice na say a right to abortion no dey deeply rooted in di Nation’s history and traditions,” di conservative opinion reportedly tok.

Speaker of di House of Representatives Nancy Pelosi and Senate Majority Leader Chuck Schumer – both Democrats – don issue a joint statement reacting to di leak.

“If di report dey accurate, di Supreme Court dey ready to inflict di greatest restriction of rights in di past 50 years”, di statement read.

E add say di decision by “Republican-appointed Justices” go-go down as an “abomination, one of di worst and most damaging decisions in modern history”.

One of America main anti-abortion organisations, National Right to Life, say e go wait for di Supreme Court official opinion on di matter before speaking out.

Wetin go happun if Roe v Wade dey overturned?

Roe v Wade: Politico leak suggest Justice Alito want SCOTUS to overturn abortion rights

Getty Images

Anti-abortion activists and pro-abortion supporters don already take to di streets of Washington to demonstrate.

Dis be after news say U.S. Supreme Court fit overturn di 1973 Roe v Wade ruling wey legalized abortion nationwide.

A woman right to do an abortion through di first trimester of pregnancy na im dey protected nationally in 1973.

E follow di Supreme Court landmark 7-2 ruling in Roe v. Wade case.

If Supreme Court of United States [SCOTUS] do wetin dey di leaked Politico report, e mean say dat right of a woman don get K-leg.

Immediately, sake of statutes wey already dey books and “trigger” laws wey dem design for such occasion – abortion go dey illegal in 22 states of USA.

Now abortion rights supporters in Washington don call on Democrats inside Congress to take action to protect access to abortion.

Experts say di leak of a U.S. Supreme Court draft opinion wey fit overturn di constitutional right to abortion na major breach of confidentiality.

Reports say e don heightened di stakes ontop di already politically-charged case inside America.

Roe v Wade case – US Supreme Court ruling in 1973

Plaintiff Jane Roe, wey later dey identified as Norma McCorvey na unmarried pregnant woman wey no fit an abortion under Texas law.

Fo dia e dey illegal unless to save di life of di mother.

Roe lawyers said she dey unable to travel out of di state to obtain an abortion and argue say di law no dey real and block on her constitutional rights.

“Pregnancy dey often come more than once to di same woman, and in di general population, if man go survive, e go always be with us.”

Na so Supreme Court Justice Harry Blackmun, a Republican wey by President Richard Nixon nominate, write inside di sweeping majority opinion.

SCOTUS decision rule say Texas law infringed on women right to privacy, e dey overly broad and violate di due process clause inside U.S. Constitution Fourteenth Amendment.

Roe v Wade: Politico leak suggest Justice Alito want SCOTUS to overturn abortion rights

Reuters

“Dis right of privacy…dey broad enough to encompass a woman decision whether or not to terminate her pregnancy.

“Di bad condition say di State go impose upon di pregnant woman by denying dis choice altogether dey clear.

Five Republican-nominated judges dey among di majority.

Di court rule say di state fit regulate di procedure during di second trimester and even ban am in most circumstances in di third.

Justices Byron White, a Democratic appointee, and Republican-nominated William Rehnquist, later U.S. chief justice, no agree to di ruling alias dissented.

Di decision provoke gbasgbos among social and judicial conservatives, wey for long don dey make move to revoke am.

Roe v Wade Politico leak – What next, wetin dey at stake?

Analysis box by Anthony Zurcher, North America reporter

BBC

Assume for a moment say dis draft opinion become law of di land.

Immediately, sake of statutes wey already dey books and “trigger” laws wey dem design for such occasion – abortion go dey illegal in 22 states of USA.

Di illegality of di procedure go become battle during election year.

Dis na di significance of wetin dey happun for Supreme Court. However, draft opinions na just draft opinions.

And accounts of justices wey don shift dia views as di opinion-drafting process dey go on within di court chambers. Dis kind leak bypass all dat.

For most of US history, di Supreme Court don operate like Mount Olympus as dem dey hand down opinions from high.

Dis leaking wey dey spread don shatter dis kind tin.

Pipo gass wait to see wetin e go mean for di legitimacy of di judicial process for US.

But inside di institution, e no go dey wrong to say all trust between di judges don disappear.

Inside era wey political customs don dey broken, anoda big piece don fall.

Na Republican presidents appoint six of di nine current justices of di court. Na Democratic presidents pick di three odas.

Politico report suggest say Justice Alito and four oda justices wey Republican appoint – Clarence Thomas, Neil Gorsuch, Brett Kavanaugh and Amy Coney Barrett – support di move.

E no dey clear how Chief Justice John Roberts go vote.

Roe v Wade: Politico leak suggest Justice Alito want SCOTUS to overturn abortion rights

AFP

Di three justices wey Democrat appoint – Stephen Brever, Sonia Sotomayor and Elena Kagan – dey work on at least one opposition, Politico report.

If dem issue am as a majority ruling, Justice Alito opinion go overturn di constitutional right to abortion for US.

And dis go allow individual states to ban di procedure or place more restriction ontop am.

Di American Civil Liberties Union tok say if dem confirm am, di decision “go deprive half of di nation a fundamental, constitutional right wey millions of women don enjoy for ova 50 years”.

Di case involve one challenge to Mississippi ban on abortion afta 15 weeks, wey di justices hear for December.

According to di BBC US partner CBS News, di leak go cause plenty damage to one of di institutions wey pipo respect well well for US.

Chief Justice Roberts fit order full-blown investigation wey go involve di FBI to uncover di sources, CBS report.

Dis kind leak no even happun for di year 2000 US presidency between George W Bush and AI Gore.

Rove v Wade in 1973 give women for US absolute right to abort pregnancy wey dey three months and limited right in di second trimester.

Roe v Wade: Politico leak suggest Justice Alito want SCOTUS to overturn abortion rights

Reuters

In 1992, inside Planned Parenthood v Casey, di court rule say state no fit place “undue burden” on women wey dey seek abortion before foetus fit survive outside di womb, at about 24 weeks.

Na about 630,000 reported abortion dey for di US in 2019, according to di US Centres for Disease Control.

Dis na about 18% decrease if you compare am with 2010.

Women wey dey dia 20s account for di majority of abortions – in 2019 about 57% dey dis age group.

Di highest of abortion na from Black Americans – 27 per 1,000 women aged 15-44.