Prince Philip: A life in pictures of Queen Elizabeth II husband

Duke of Edinburgh, 1977

BBC
Dem born di Duke of Edinburgh for di Greek island of Corfu on 10 June 1921. Im family tree include members of di royal families of Denmark, Germany, Russia and Britain.

Philip as a young boy

Getty Images
Prince Philip na di only son of Prince Andrew of Greece and Princess Alice of Battenberg.
Prince Philip of Greece, later Duke of Edinburgh, with his schoolmates at the MacJannet American school in St Cloud. The prince is the second boy from the left.

Getty Images
Di prince begin e education for France for di MacJannet American school for St Cloud and is seen here with e schoolmates. For di age of seven im go live with e Mountbatten relatives for England, wia im attend prep school for Surrey.
Prince Philip at Gordonstoun wen e be 16

PA
Im later attend Gordonstoun boarding school, wey educational pioneer Kurt Hahn bin establish for northern Scotland, and e perform well-well for sport.

Duke of Edinburgh, Royal Navy, Portsmouth

PA
During World War Two, Prince Philip na di midshipman for di battleship HMS Valiant. Wen di Italian fleet dey trapped off Greece for 1941, Philip command di searchlights wey torchlight di enemy and dem mention am for dispatches.

Di engagement of Princess Elizabeth to Lieutenant Philip Mountbatten

PA
Im engagement to Princess Elizabeth dey officially announced for July 1947…

Princess Elizabeth (latterly Queen Elizabeth II) and Prince Philip, di Duke of Edinburgh, pose for their official wedding photo for Buckingham Palace, 20 November 1947

PA
…and dem marry 20 November dat year.
Queen Elizabeth II, Princess Elizabeth wit di Duke of Edinburgh for Treetops, Kenya 05/02/52circa

Getty Images
Prince Philip dey wit Princess Elizabeth for Treetops Hotel for Kenya when she find out say her papa don die and now she don become queen – dem take dis foto some days earlier

Di Duke of Edinburgh for di Roehampton Club, where e dey play for Cowdray Park for di semi-finals of di Roehampton Cup

PA
Di prince for here dey play polo for Cowdray Park for di semi-finals of di Roehampton Cup. E be one of di leading polo players for Britain.
Di Duke of Edinburgh dey bat during di 12 a side cricket match between di Duke of Edinburgh and di Duke of Norfolk

PA
Di duke also be cricketer. Here im team, wey be former England stars, di Duke of Norfolk wey be dia captain join dem togeda, wit Sussex players.
Queen Elizabeth II and Prince Philip, Duke of Edinburgh visit di seventeenth century Taj Mahal during their six-week royal visit to India, 29th January 1961.

Getty Images
Prince Philip follow di Queen go one six-week royal visit to India for 1961.

Di Queen and Philip and dia four children

BBC
Di duke and Queen get four children, (from left) Edward, Andrew, Anne and Charles, pictured here in the 1960s.
Queen Elizabeth II and di Duke of Edinburgh during dia visit to a farm on their Balmoral estate, to celebrate their Silver Wedding anniversary

PA
For here di couplebin visit one farm for dia Balmoral estate, to celebrate their Silver Wedding anniversary.
Di Queen and di Duke of Edinburgh, both of dem wear di Maori Kahu-Kiwi (Kiwi feather cloaks) for Rugby Park in Gisborne, for di North Island of New Zealand wen dem attend di opening of di Royal New Zealand Polynesian Festival as their Silver Jubilee Tour continue

PA
For 1977 di prince follow di Queen as she celebrate her Silver Jubilee. Two of dem wear di Maori Kahu-Kiwi (Kiwi feather cloaks) for Rugby Park in Gisborne, on di North Island of New Zealand wen dey attend di opening of di Royal New Zealand Polynesian Festival for February.
Queen Elizabeth II and di Duke of Edinburgh wave as Concordefly pass di Royal Yacht Britannia as di royal couple near Barbados

PA
Later dat year di royal couple wave as Concorde fly pass di Royal Yacht Britannia as dem near Barbados.
Di Union flag-draped coffin of Lord Mountbatten bin rest one one catafalque during di funeral service for Westminster Abbey. Royal mourners (l/r) Queen Elizabeth II, her husband Di Duke of Edinburgh, Queen Elizabeth Di Queen Mother and di Prince of Wales, 5 September 1979

PA
For August 1979, one IRA bomb blast di boat wey di Queen cousin, Lord Louis Mountbatten dey for Ireland and e die. Di Duke of Edinburgh go back UK afta e hear di tori, as e don before dat time take part for one coach-driving championship for Normandy, northern France.
Duke of Edinburgh sit on top elephant as e visit di Kanha Game Reserve, 1983

PA
Nature and conservation na lifelong passions of di Duke of Edinburgh and e be di natural choice to become di international president of wetin be di World Wildlife Fund dat time.
Di Prince of Wales wit di Princess of Wales, baby Prince Harry, Prince William, di Duke of Edinburgh, Prince Edward, Queen Elizabeth II and Princess Anne on di balcony of Buckingham Palace, London to watch di fly past

PA
For 1985 di Duke of Edinburgh dey surrounded by im family, including di young princes William and Harry, as dem gada to watch one flypast over Buckingham Palace afta Trooping di Colour.
South African President Nelson Mandela, and di Duke of Edinburgh

PA
For 1996 di duke escort di South African President Nelson Mandela as he prepare to review one honour guard for Horse Guards Parade for di first day of im state visit to Britain.
Queen Elizabeth II (right) and di Duke of Edinburgh (centre right) wen dem visit market stalls for Kingston town centre, during di Queen Golden Jubilee visit to West London

PA
Prince Philip support die Queen for more than 60 years of her reign, including di Golden Jubilee celebrations for 2002.
Di Duke of Edinburgh attend di Presentation Receptions for di Duke of Edinburgh Gold Award holders, for di Palace of Holyroodhouse for Edinburgh, 2010

PA
Di prince organize di Duke of Edinburgh Award scheme, wey dey aimed at developing young pipo abilities, for 1956. For here e dey share joke wit di Duke of Edinburgh Gold Award holders for Holyroodhouse for 2010.
Di Duke Edinburgh compete for di Sandringham Country show Horse Driving Trials wey happun for Norfolk Estate

PA
Di duke continue to dey compete for sport even wen e don dey old, including dis carriage-driving event for Sandringham for 2005.
Britain Prince William kiss im wife Kate, Duchess of Cambridge, for di balcony of Buckingham Palace, afta di wedding service, for London, 29 April 2011

AFP
Thousands gada outside Buckingham Palace to greet di Royal Family afta di wedding of Prince Philip grandson, Prince William, to Catherine Middleton for 2011.
Prince Philip, Duke of Edinburgh, dey wave as e stand onboard diSpirit of Chartwell during di Thames Diamond Jubilee Pageant

AFP
Twelve months later, di prince wey appear to get beta join di Queen on di royal barge, di Spirit of Chartwell, wey form part of di rain-drenched Diamond Jubilee river pageant on 3 June 2012. He and di Queen stand for most of di 80-minute journey, as 1,000 boats follow dem travell seven miles down di River Thames to Tower Bridge. However, di duke land hospital sake of bladder infection before di Diamond Jubilee concert on 4 June.
Princess Anne attend equestrian eventing wit Prince Phillip di Duke of Edinburgh,

Getty Images
Afta e recover, e dey okay to follow Princess Anne to watch Great Britain equestrian team, wey include im granddaughter Zara Phillips, wey dey compete for di eventing for di 2012 London Olympics.

Queen Elizabeth II and di Duke of Edinburgh as dem attend service for Westminster Abbey for central London to mark di 60th anniversary of di Queen coronation

PA Media
For June 2013 di duke attend one church service for Westminster Abbey to mark di 60th anniversary of di Queen Coronation.
Queen Elizabeth II and di Duke of Edinburgh wit elephant for ZSL Whipsnade Zoo, where dem officially open di zoo new Centre for Elephant Care as part of visit to Bedfordshire

PA Media
For April 2017 di Duke follow im wife to open one new Centre for Elephant Care for ZSL Whipsnade Zoo for Bedfordshire. For May e announce say im wan stop to dey go public engagements at di age of 95, wit di full support of di Queen.
Queen Elizabeth II and di Duke of Edinburgh observe one minute silence at di start of a garden party for Buckingham Palace for London, 23 May 2017

PA Media
Join wit di Queen di Duke bin observe one minute silence for di start of a garden party for Buckingham Palace on 23 May 2017 in tribute to dos wey die for di Ariana Grande concert for Manchester.
Di Duke of Edinburgh during one visit to di headquarters of di Royal Auxiliary Air Force's (RAuxAF) 603 Squadron for Edinburgh

PA Media
Di duke na di longest-serving royal consort for British history.

All photographs subject to copyright.