Unilag Crisis: Wetin you need to know about Folasade Ogunsola wey be Unilag acting vice chancellor

Senate members of University of Lagos don elect Professor Folasade Ogunsola as di acting Vice-Chancellor of di school.

Dis na afta Nigeria president Muhammadu Buhari, ask di pro-chancellor and vice chancellor to step aside until special panel wey dem set up investigate di kwanta wey dey affect di University submit dia report.

One member of Senate and Dean of Student Affairs, Ademola Adeleke tell BBC pidgin say dem elect Prof. Ogunsola afta di sharp-sharp meeting wey di school senate do today.

“Di special visitation panel wey president set up direct make Senate meet immediately and nominate one of dia members as acting vice chancellor to stand in while di visitation panel dey do dia work.

Dis nomination we do am by election and we go now pass am to council for approval. We elect Folasade Ogushola as acting Vice Chancellor.

Di process be say senate nominate and council confirms. “

University of Lagos

BBC

Oga Adeleke say e now know how long e go take for council to confirm but dem get two weeks to complete dia work as e be say federal goment don dey involve for di Unilag crisis.

Before now, Tok tok pesin for di ministry of education, Ben Goong, say di special visitation panel wey Preisdent Buhari set up suppose submit dia report in two week time.

Wetin you need to know about Folasade Ogunsola

Professor Folasade Ogunsola na Professor of Clinical Microbiology, College of Medicine, University of Lagos, Nigeria. Her research interest and work dey centered around di diagnosis and prevention of infectious diseases and antibiotic resistance.

For ova 20 years she don dey involve in raising awareness on Infection Control inside Nigeria.

She be di founding member of di Nigerian Society for Infection Control for 1998 and don assist to set up infection control programs for institutions around di kontri.

She get strong interest for di application of Infection Control principles for di prevention of disease transmission and antimicrobial resistance in low resource settings.

Professor Folasade na member of di Global Infection Prevention and control Network.