Bayelsa election tribunal: Douye Diri chop sack from Govnorship Election Petitions Tribunal wey order fresh election

Bayelsa State Governorship Election Petitions Tribunal wey dey sidon for Abuja on Monday cancel alias nullify di 16 November, 2019, governorship election wey hold for Bayelsa state.

One three-member panel of di tribunal wey Justice Ibrahim Sirajo lead, rule say INEC unlawfully remove alias exclude di Advanced National Democratic Party from di election.

Di tribunal come order INEC to conduct fresh election within 90 days. Tori be say na five petitions wey dey before di panel. dem bin deliver ruling on Saturday and di rest two on Monday.

INEC for Bayelsa tell BBC Pidgin say dem just dey see di judgement for local media and afta dem receive am dem go make final statement on dia next move.

Dis election mata na one of di pre-election cases before di Bayelsa election tribunal, according to wetin BBC Pidgin find out.

Dis judgement dey come just two days afta di same Election tribunal bin don dismiss di petitions wey Alliance for Democracy, United Peoples Congress and Liberation Movement parties bin file.

For inside judgment wey all three judges of di tribunal agree to give wey Justice Owodunni deliver on Saturday 15 August, 2020, di Tribunal say di petition wey Owei Woniwei of Alliance for Democracy bring dey incompetent and lack merit as dem fail to prove di allegation of forged declaration of age and National Youth Service NYSC certificate against di Deputy Governor, Sen. Lawrence Ewhrudjakpo .

So as e be so, di tribunal sack Govnor Diri, order fresh election just days afta im bin jubilate say e win case for di same court.

Tori be say court ruling and court judgement on di same mata na two different tins wey fit come out differently.

Remember say dem swear in Douye Diri of di People’s Democratic Party PDP as Governor barely 24 hours to di inauguration of David Lyon of di All Progressives Congress APC after Supreme Court deliver judgement say im running mate, Sen. Biobarakuma Degi -Eremienyo present false information to INEC.

Govnor Douye Diri enta office on 14 February, 2020 just one day afta one supreme court judgement knack out di APC candidate David Lyon wey INEC bin declare winner.

Gov. Douye Diri Reacts: I go ppeal dis judgement

Meanwhile, Bayelsa State Governor Douye Diri say im go appeal di Tribunal ruling

For statement wey di Acting Chief Press Secretary to di Governor Daniel Alabrah sign, di Governor say im don instruct im lawyers to file di necessary papers

“We trust di judiciary and we dey appeal di judgement. Wit God on our side, we go get justice. Dis na court of first instance. We get right to appeal even up to di Supreme Court.”

Di Governor come tell members of di Peoples Democratic Part and im supporters to remain calm and law abiding.