Kebbi police arrest papa and stepmothers wey tie boy with goats for two years

Kebbi state Police Command for northern Nigeria say dem don arrest di papa plus di two step mothers of 10 year old Jubril Aliyu wey dem tie with goats for two years.

Deputy Superintendent of Police Nafiu Abubakar, confam di arrest. Im also yan say dem still dey investigate why di parents maltreat di boy sotey dem tie am, come make am dey sleep with goats.

“We thank God say di boy dey hospital at di moment wia e dey receive treatment and investigate dey continue for dis mata.”

Barrister Hamza Attahiru of Human Rights Network na one of di pipo wey follow rescue Jubril, e tok say dem see Jubril wia dem tie am up wit goats and wen dey ask di wives of di father dem tok say na sake of di boy no get sense.

“We meet am as wia dem tie am wit goats, inside dried excreta both im own and di goats own. Im bin dey eat am. Di wives of im father say e get mental problem plus epilepsy na why dem put am dia.”

“As di boy don spend di long time wit di animals, im don even dey to behave like one, e dey sad.”

But inside anoda video wey show interview wit di wives of im papa, one of dem say she dey give am food.

According to Kebbi state goment wey release statement on di issue, di story of Jubril na heartbreaking one because after im mother die two years ago na im life change for am.

Wia di two wives of di father join hand to maltreat di boy for no reason to di extent of sleeping with goats, eat di food wey di goats remain, or sometimes im own excreta as na wia dem tie am be im toilet.

Video of how human rights network and Police go rescue Jubril for Badariyya area of Kebbi bin dey trend for social media.

Govnor of Kebbi state Abubakar Bagudu don give order for full investigate on top Jubril mata to start afta e also announce say im goment don take full charge of di boy from now on, from im health to education and general wellbeing.