We ready for ground offensive – Hezbollah deputy chief speak afta death of leader

 Hezbollah leader Hassan Nasrallah

EPA
Israel kill Hezbollah leader Hassan Nasrallah, wey dey dis posters for Beirut, inside one strike on Friday

Hezbollah deputy chief Sheikh Naim Qassem don react to di killing of dia leader, Hassan Nasrallah by di Israeli strike on Friday.

Dis go be di first speech by a high-rank Hezbollah official since dem lost dia their leader.

For im speech, di deputy chief tok say Hezbollah ready for Israeli ground offensive, and go keep up di fight against Israel.

E say di group go continue dia operations and dia attacks so far na small thing.

E also tok say Hezbollah know say di battle “fit dey long”, and di options dey “open to dem”.

“We ready for a ground invasion, and we go come out victorious,” e tok.

On who go replace Hassan Nasrallah, e say dia council go decide soon. But e say all those commanders and top-rank officials get deputies wey fit step in.

Oga Qassem end im speech by calling for “patience”.

Meanwhile, Palestinian militant group Hamas say Fateh Sherif Abu el-Amin, di group leader for Lebanon, don also dey killed togeda with some of im family members inside one Israeli air strike for southern Lebanon.

Hamas say dem kill am inside strike “for im home for di Al-Bass camp for south Lebanon”. Di state-run Lebanese National News Agency report air strike on di camp near di southern city of Tyre.

Although Hamas dey based for Gaza – wia Israel don dey fight since di 7 October attacks – e also get presence for Lebanon.

Both Hamas and Hezbollah get backing and funding from Iran.

Also, di Popular Front for the Liberation of Palestine militant group say three of im leaders also dey killed inside strike on central Beirut.

Di PFLP na a left-wing Palestinian armed group, and di second largest faction for di umbrella Palestine Liberation Organisation (PLO).

Dis dey come as Israel bin kill Hezbollah leader Hassan Nasrallah inside strike on Friday wey, Israel say, bin also kill 20 oda key figures for di group – Di Iran-backed group confam di leader death di next day.

One senior general for Iran Revolutionary Guards Corps, Abbas Nilforoushan, also die for di strike, Iran state media tok.

US President Joe Biden bin describe di strike as a “measure of justice” for victims of Nasrallah, but Iran supreme leader don say im death “no go dey unavenged”.

Cross-border fire between Israel and Hezbollah for Lebanon bin dey reported throughout di weekend, with Israel saying dem kill additional senior figures from di militant group.

Apartment building for central Beirut wey dey hit overnight

Getty Images

Wetin Iran go do?

Wetin Iran go fit do? BBC Jeremy Bowen analyse di mata.

E say, di Middle East region feel l;ike say e dey on di edge and di big question na wetin Iran fit to do.

E almost wan be like say Iran dey find dia trouble to to hit back, in di knowledge say dia retaliation go dey far stronger, and backed by di Americans.

If you look at it from di Iranian point of view, di US Navy reinforcing Israel for di Mediterranean dey dia, Israel also dey in a mood to do damage to im enemies, and thinking say dem fit dey in a position to reshape di Middle East.

Na time for tough decisions for all di participants in dis. Wetin Iran go do, wetin Israel go do, and Hezbollah, wey don record ogbonge losses including dia leader own – wetin dem go do?

One thing Iran watchers and some Israelis dey warn about na say if di so-called ring of fire – Iran build-up of allies and proxies wey dem don form over many years – now dey show say e get comma, and e no dey effective, e leave di question of whether dem fit decide to develop a nuclear weapon.

E dey possible – say dem dey close to di technical knowledge. If so, and di Americans discover am, den e fit lead to a US bombing campaign against Iran. Dat na di kind wider scenario wey pipo dey worried say dis kasala fit lead to.

Wetin seem to be di rules of di game don go. Nobody know where things dey go, and for Israel allies, wey continue to call for a ceasefire and a diplomatic solution, dat level of unpredictability and insecurity full of dangers and possible mistakes.

Source