How lion attack zookeeper wey wan feed am for Olusegun Obasanjo presidential library wildlife park

Picture of lion wey dey squeeze face

Getty Images

Di police for southwestern Ogun state, Nigeria don confam say lion bin attack di man wey dey handle am for zoo.

Di incident happun for di Olusegun Obasanjo presidential library (OOPL) wildlife park for Saturday.

According to di tok tok pesin for di police in Ogun state, SP Omolola Odutola, di lion handler dey identified as Babaji Daule wey be 35 years old.

Di victim na trained handler of di lion but di lion attack am and e die.

According to di police tok tok pesin, “di Area commander metro don report a tragic incident wey occur on di 28th of September, 2024 at about 1940hrs, for OOPL zoo say lion kill one Babaji Daule ‘M’ 35 years wey be trained handler of a male lion.”

Dis dey come afta authorities of Obafemi Awolowo University, Ile-Ife, Osun state confam death of dia staff wey lion attack.

Di University say e die as e dey try to rescue one female colleague wey di lion attack.

Tok-tok pesin for di institution, Abiodun Olanrewaju, tell BBC say di incident happun on Monday, 19 February 2024 wen di unnamed female colleague dey feed di nine-year-old lion.

OOPL say di zookeeper bin listen to guests wey come afta closing time, to show dem how di lion dey feed.

Di zookeeper no lock di safety protection gate bifor e begin dey feed di animal, and na how di lion take attack am be dat.

“Di zookeeper agree to take di guests wey come afta closing time to demonstrate di feeding routine of di lion for di inner enclosure.”

OOPL add say, “di zookeeper bin dey feel comfortable wit di animal and leave di di safety protection gate open and proceed to feed di animal. Di animal tear am and e die on di spot.”

Di management of di park say di zookeeper work outside di standard feeding routine of di park, but dem don begin investigation as dem report di matter give di police.

Similar previous cases of lion attack

For 2019, lions for one game farm wey dey east of Pretoria, South Africa bin attack and kill dia 70 years old owner wey bin dey train dem.

Di owner wey local media say im name na Leon van Biljon, AKA “di Lion Man” bin enta wia di lions dey, for cage, to fix broken fence wen one of di lion wey im trust attack am from behind.

Dis attack happun for di Mahala View Lodge near Cullinan, wey be Leon van Biljon house.

According to report of how e take happun, Van Biljon bin sit down back di three lions as im dey fix di fence, then one of di come attack am for neck.

Afta di attack, staff members come shot di three lions die.

Same year, dem warn pipo wey dey live for north-east area for South Africa to dey careful as authorities bin dey search for 14 lions wey dem believe say escape from Kruger National Park.

For 2018, lion kill one zookeeper for amusement park for Northern Nigeria.

Di lion run comot from im cage for di popular Gamji Gate amusement park for Kaduna City and e wound di zookeeper, Mustapha Adam, for im neck.

Authorities den say di lion enter im cage back after di attack.

Wetin to do to avoid lion attack

Behaviour of lions dey different from region to region.

John Coppinger of di BBC wildlife magazine tok on how you fit avoid lion attack.

  • Some pipo wey dey go zoo for recreation purpose gatz dey careful how dem dey go close to lion.
  • No dey go too too close to lions, especially in case of lions wey dey mate or lionesses wey dey wit dia children (cubs).
  • Different circumstances fit trigger different behaviour for lion to attack pesin. During courtship, male lions dey always dey very aggressive and you no suppose go near am not even inside vehicle.
  • Lioness wit cubs dey naturally protective and you gatz give am plenti space.
  • You gatz also know say lions dey lose dia fear of humans for night and dem go become more dangerous and fit attack.
  • Dey careful for night and avoid to dey camp for areas of wia lions dey.

Source