Ukraine millionaire businessman, wife die for ‘massive’ attack from Russia

One of Ukraine’s richest businessmen don die wit im wife for one “massive” Russian attack wey happun for di southern city of Mykolaiv.

Oleksiy Vadatursky, 74, and im wife Raisa die wen missile hit dia home overnight, Ukrainian media tok.

Oga Vadatursky na di owner of Nibulon, a group wey dey involved in grain exports.

Di businessman bin receive di “Hero of Ukraine” award.

Mykolaiv mayor Oleksandr Senkevych say e be like say di di shelling na di heaviest Russian bombardment of di city so far.

Damage bin dey to houses, one hotel, one sports complex, two schools and one service station.

Mykolaiv dey on di main route to Odesa, Ukraine’s main port, and Russia don hit am repeatedly.

Di leader of di region Vitaliy Kim say Oga Vadatursky “do a lot for di Mykolaiv region, a lot for Ukraine.

“Im contribution to di development of di agricultural and shipbuilding industry, di development of di region dey invaluable,” e tok on Telegram.

Nibulon don build many storage facilities and oda infrastructure for exporting grain.

Ukraine and Russia na major exporters of wheat and oda grains, and di disruption of exports wey di war cause don make food prices to go up worldwide.

Di two kontris sign a UN-brokered agreement for Turkey last week, wey dey aimed to ease di food crisis.

But Ukrainian shipments dey expected to dey slow amid heavy security checks.

Ukraine accuses Russian forces say dem dey steal grain from farms on land wey dem occupy and dem dey export am via Crimea.

Russia don deny di claim.

Blow to Russian Navy Day

Vladimir Putin and Sergei Shoigu - Oleksiy Vadatursky: Ukraine millionaire businessman, wife die for Russian missile attack

EPA
President Putin and Defence Minister Sergei Shoigu (R) review warships for St Petersburg

Meanwhile, Russia don cancelled Navy Day celebrations for occupied Crimea.

Di reason wey Sevastopol Governor Mikhail Razvozhayev give be say one alleged Ukrainian drone strike on di Black Sea Fleet headquarters.

Di fleet don base for Sevastopol since.

But one senior Ukrainian official, Serhiy Bratchuk, dismiss di Russian report as a “provocation”.

“Di liberation of our Crimea go take place differently and much more efficiently,” e tok.

Russian forces annex Crimea for 2014. International community condemn am and describe am as illegal. Russia chop sanction ontop am.

Navy Day na annual Russian holiday, and celebrations dey take place across Russia on Sunday. President Vladimir Putin dey oversee events for St Petersburg, im home city.

We still dey shook eye on dis tori… dey refresh dis page for more updates.