Wetin be kidney transplant, why e fit fail?

Plenty fans, celebrities and well-wishers of one ogbonge Nigerian Music Video Director ThankGod Omori, wey pipo sabi as TG Omori dey pray for im health, as dem encourage am to get well soon.

Dis dey come afta TG Omori wey don direct and produce plenty top Nigerian musicians music videos reveal one failed kidney transplant process and request for prayers.

For one post on im social media account on Wednesday 28 August, Oga Omori disclose say one kidney transplant process wey im do for one hospital for Lagos state, Nigeria largest commercial city fail, and add say im no wan die.

“One year afta my kidney crash, I just get one failed transplant” for one Lagos hospital. “Pray for me,” e add.

According to Omori tweet on Tuesday, e say na im only brother donate one of im kidney give am, so im go fit live again. “Yesterday my only brother give me one of im kidney so I fit live again.”

But im tweet on Wednesday show say di kidney transplant procedure fail.

“I enta theatre three times, I no dey destined to die today,” e tok.

Kidney transplant get many advantages and some disadvantages, wey fit make am too risky for some patients.

Di main disadvantages na say di surgery fit put stress on di patient heart or lungs. Di patient go need take powerful immunosuppressant medicines afterwards, wey fit lead to oda serious medical problems. Some patients dey experience psychological difficulties afta di transplant.

Di music director wey don dey away from di public for some time now, bin share foto as e dey hospital dey receive oxygen and e post “Keep my spirit alive”

Although e bin don dey post some coded tweets about im health before di recent transplant.

Last month, di award-winning music producer bin write on im X account, “If I cross your mind, sometimes say a prayer for me.

Following im revelation, netizens don also dig up tweets wia di TG Omori bin tok about how fake drinks make am land am for hospital.

Wetin be kidney transplant?

Di National Health Service (NHS) say Kidney transplant na major operation and na treatment option for many patients wey get long-term kidney failure.

During kidney transplant, doctors go remove kidney from one pesin (di donor) and give anoda pesin (di recipient).

Kidney fit dey donated from living donors or from pipo wey don die (deceased donors).

Kidney transplant fit improve or prolong di life of many patients wey get long term kidney failure. Kidney transplant no be cure as e get risk and benefits too.

Doctors dey carry out tests to determine if pesin wey get kidney failure go fit get kidney transplant. Kidney transplant no dey for everybody.

Who fit get kidney transplant?

Kidney transplant usually na di best treatment for kidney failure in patients wey dey fit enough for di operation. But di benefits must pass di risks.

To get kidney transplant:

  • Di patient must get long-term kidney disease
  • Di patient must dey well enough to cope wit major surgery
  • Di transplant gatz get a good chance of success
  • Di patient must fit take di required daily medicines wey dey needed afta kidney transplant, including immunosuppressant medicines

Why kidney transplant dey fail

According to the National Kidney Foundation, many reasons dey why kidney transplant fit fail.

Rejection of a transplanted kidney

Dis na di most common reason why kidney transplants dey fail.

Rejection na wen di patient immune system start to dey ‘attack’ di transplanted kidney. E dey happun wen di patient immune system recognise say di kidney dey come from different person and think say e no suppose dey there.

Rejection still fit occur even wen di patient dey take all im melecines. If you no take your melecines as doctors prescribe am, di risks of rejection dey higher. E dey very important for patients to take all im tablets exactly as dem prescribe am for dem.

Rejection dey happun between 10 to 15 for every 100 patients during di first year after a kidney transplant.

Some patients get higher risk of rejection pass odas.

Blood Clots

Dis condition dey occur wen di blood for di blood vessels to di transplanted kidney clot, so blood no fit flow go di kidney. Dis dey most likely to happen shortly afta di surgery.

Fluid Collection

If fluid collection dey around di kidney, di pressure of di fluid fit damage di kidney if e no dey treated.

Infection

Wen infection dey di kidney, e fit cause permanent problems for die kidney, especially if dem no quick see and treat am early.

Side Effect of Medicines

Some medicines fit dey harmful to kidneys.

Donor Kidney Problems

Transplant surgeons go only offer patient kidney dem believe say go work, but sometimes problems fit dey wit di donor kidney wey no dey expected and dat go make di kidney no function well. If di kidney no work well, e dey likely say e no go last long.

Who be TG Omori

TG Omori, wey also dey known as Boy Director na Nigerian music video director and cinematographer.

E don direct music videos for recording artists across various genres wey include Olamide, Wizkid, Burna Boy, Tekno, Kiss Daniel, Fireboy DML, Falz, Timaya, Naira Marley, and many odas.

For one tweet e post on im X account for 2022, e reveal say im don produce a total of 405 music videos between 2018 and June 2022.

“Shot over 405 videos in 5 years,” e add say in those years, e shoot 15 out of dem for Olamide YBNL record. “YBNL 15.”

E don assure im fans say im go get well soon. “Will be up soon. I promise!”

Source