Who be Doctor Ganiyat Popoola wey her kidnap cause strike across Nigeria?

Drs dey do protest sake of di kidnap of Dr Ganiyat Popoola

BBC
Di Association of Resident Drs bin don do nationawide protest sake of di kidnap of Dr Ganiyat Popoola

Di National Association of Resident Doctors (NARD) for Nigeria don start a seven-day warning strike sake of dia colleague, Dr Ganiyat Popoola wey jaguda pipo bin kidnap since December of 2023.

Sake of di strike wey go happun for all di tertiary health institutions for Nigeria, doctors go withdraw service for patients wey dey come in from outside, though patients wey already dey hospital go dey get some palliative care, di association tok.

“During di strike, concessions no go dey and emergency care no go dey,” NARD President, Dele Abdullahi, tell tori pipo on Sunday, 25 August.

Na on December 27, 2023, bandits kidnap Dr Popoola and her husband and nephew for dia home wey dey inside di staff quarters of di National Eye Centre, Kaduna.

Dem later release her husband for March dis year, afta di family pay ransom of 60 million naira cash, and items like bags of rice, beans, motorcycles, wey cost more dan 10 million, according to Dr Ebueburho Majirie, di NARD President for Edo State.

But she and her nephew still dey di kidnappers hand.

Who be Ganiyat Popoola?

Dr Ganiyat Popoola na staff of di National Eye Centre for Kaduna, and na she be di Registrar Ophthalmologist for di hospital.

She also be member of di Medical Women Association of Nigeria.

She get five children.

Her husband Nurudeen Popoola na nurse, and im also be personnel of di Nigerian Airforce wia im rank na ‘Squadron Leader’.

AbdulMugniy Folaranmi, di nephew wey dem kidnap wit am na 100 level student for di Airforce Institute of Technology, Kaduna.

According to Dr Ebueburho Majirie, so far di Popoola family don pay a total of 120 million naira in cash and items as ransom to di kidnappers yet dem neva fit secure dia release.

On why e take eight months bifor di Association of Resident Doctors begin make noise for di release of Mrs Popoola, di national president of di association, Dr Dele Abdullahi tell BBC say “di family bin dey explore diplomatic route initially, but na now dem give us di permission to try our own option”.

‘Understand wit us’ – Doctors tell Nigerians

Di NARD Chairman for di University of Port Harcourt Teaching Hospital (UPTH), Dr Noble Dumbari, tell BBC News Pidgin on Monday say di strike na sake of say dia hands dey tied as goment no wan reason dia demands.

“We neva get beta response from goment following our protest waka for di release of our colleague from kidnappers hand. So na im make we wan use dis strike to make goment to do di needful becos goment get wetin e take to rescue our colleague from captivity.”

“Wen we say total strike, e mean say all services wey resident doctors dey render go dey withdrawn for di period of di strike action and e include emergency care among oda care dem dey offer.

“Consultants go dey run di clinics but we di Residents no go work and e go make dia work difficult becos na we be di foot-soldiers as na we dey do majority of di work.”

“We dey ask di patients to understand wit us for dis strike becos no be somtin we just decide to do like dat,” Dumbari tok.

Source