Federal goment go fit afford to pay corps members 70,000 naira allowance?

Afta Nigerian President Bola Tinubu sign di National Minimum Wage (Amendment) Act 2024 into law, di leadership of di National Youth Service Corps (NYSC) also dey advocate for corps members to receive 70,000 naira ($43) like civil servants.

Di NYSC Director-General, Brigadier, General YD Ahmed, bin appeal for di consideration of corps members in di implementation of di approved new minimum wage by di federal goment for public servants.

E bin make di appeal wen e visit di Chairman, National Salaries, Income and Wages Commission, Ekpo Nta, for im office for Abuja on Friday, 23 August.

Oga Ekpo respond say as soon anytin come, di commission go do di “needful”.

Many corps members bin express dia disappointment ontop internet as dem receive di sum of 33,000 naira ($20) allowance for di month of July.

Nigeria goment go fit pay NYSC 70,000 naira allowance

Nigerian economist Aliyu Ilias tok say goment go fit afford to pay corps members 70,000 naira.

E explain say di goment go need add di corps members salary into di supplementary budget.

Ilias tok say e go help low earners to keep more moni becos dem go get more moni to spend and save.

“Goment fit afford di minimum wage, if dem fit afford to pay workers di minimum wage, dem fit pay corps members 70,000 naira.”

Anoda Nigerian economist Ola Oladele tok say e dey high make goment dey pay corps members 70,000 naira monthly but dem fit add am to di budget and e go accommodate di changes.

She add say corps members dey add value for di economy, and to pay dem 70,000 naira minimum wage no be bad idea.

How NYSC allowance go impact Nigeria economy

Wit di current inflation wey dey 33.40%, many corps members living cost don high and di increment fit help dem solve dia financial needs.

According to Oladele, moni go dey di economy for pipo to spend to help wit di high cost of living.

Oladele explain say high inflation also fit shele in di future becos pipo go get plenti moni to spend for di economy.

She express her concern say companies and businesses go increase salary and dem go pass di cost to consumers services and goods

“Di local minimum wage go force business to increase di salaries of dia staff and dis go pass di cost to consumers wey fit result in high inflation,” she tok.

“We need to see if our goment go manage di money supply wey go dey di system becos of di increased minimum wage.”

Source