Russia hit energy targets afta dem strike Ukraine wit ‘200 drones and missiles’

Russia attacks Ukraine

EPA

Russia launch plenti missiles and attack drones for Ukraine during di morning rush and strike energy facilities nationwide, officials tok.

Authorities report power cuts and add say water supply don stop for many places, including parts of Kyiv.

Di prime minister of Ukraine Denys Shmyhal tok say 15 regions of di kontri chop attack by Russia, wey use drones, cruise missiles and Kinzhal hypersonic missiles.

Ukrainian President Volodymyr Zelensky tok say more dan 100 missiles and about 100 attack drones na im Russia launch overnight.

Monday missile and drone salvo na Russia most intense in weeks, and dis dey come as Ukraine dey claim new ground in a major cross-border incursion into Russia southern Kursk region while Russian forces steadily inch forward for Ukraine east and close in on di transport hub of Pokrovsk.

Meanwhile, Russia don claim say dem use high-precision weapons to hit critical infrastructure for Ukraine.

Russia tok-tok pesin Dmitry Peskov tell tori pipo say di “topic of negotiations wit Ukraine don lose im relevance”.

E also say Russia dey respond to Ukraine recent incursion into di Kursk region.

Serhiy Popko, di head of Kyiv military administration say Ukraine air defences shoot down around 15 missiles and 15 drones wey target di capital city of Kyiv during Russia overnight attack.

Pipo wey die don reach at least six

At least, five pipo don dey reportedly kill for di Russia overnight aerial attack:

A 69-year-old man die for di Dnipropetrovsk region, regional head Sergiy Lysak tok.

Anoda man die wen dem hit im house for Zaporizhzhia, di regional head tok

Di mayor of Lutsk tok say one pesin die wen one “infrastructure facility” bin dey hit.

For Izyum for Kharkiv region, one man die inside one missile strike, di regional head tok.

And for Zhytomyr region for western Ukraine, one woman die afta homes and infrastructure buildings bin dey hit by missiles, di regional head tok.

Di military administration for Ukraine Dnipropetrovsk region announce one 47-year-old man die sake of Russian shelling for di city of Nikopol.

Inside one post on Telegram, di administration head Serhiy Lysak tok say dem don take six pipo to di hospital wit injuries, including one 14-year-old girl.

E don also share pictures of di site of di attack, as e tok say one supermarket, one high rise building and several cars don dey damaged.

We no get running water, Kyiv resident tok

Russia attacks Ukraine

Reuters
Smoke rise ova Kyiv afta one Russian missile strike

Roman, wey dey live for Kyiv western Solomianskyi district, tell BBC say “e bin dey veri loud dis morning”.

E say im hear three veri strong blasts so close sotay e feel like say dem bin dey “above my head”.

“Friends also tell me say dem see missiles wey bin dey shot down,” e tok.

Roman add say electricity neva cut right now, but im no get running water for a few hours.

Inside one post on Telegram, di head of the city military administration, Serhiy Popko, say drones dey come di capital and warn civilians to head to shelters for cova.

Fotos wey show di damage for Ukraine sake of di attacks

Russia attacks Ukraine

Reuters
One woman waka next to one residential building wey dey damaged during one attack for Dnipro
Russia attacks Ukraine

Reuters
Firefighters battle fire for di site of a missile strike for di Odesa region
Russia attacks Ukraine

Reuters
Buildings bin dey damaged for di city of Lutsk
Russia attacks Ukraine

Reuters
One ma for Dnipro dey sort through items next to im house wey dem destroy

Source