Denmark vs England Euro 2024 prediction, kick-off time

Jude Bellingham

Getty Images
Na Jude Bellignham score di winning goal for England to beat Serbia

England go face Denmark on Thursday evening for dia second group match for Euro 2024.

Di Three Lions dey hope to win dat game so dem fit book dia place for di knockout round

Denmark bin play 1-1 draw against Slovenia for dia opening group C match on Sunday.

Tori be say di last time wey dis two sides bin meet for di competition na Gareth Southgate team get di upper hand.

England comot Denmark, for dat match di Three Lions na di favourites to win once again for Frankfurt, despite dia own opening-day issues.

Na Jude Bellingham score di only goal for di game against Serbia for Gelsenkirchen, as Gareth Southgate men impressive start to fade badly for di second half.

Date, kick-off time and venue

Denmark vs England go kick off by 5pm WAT on Thursday June 20, 2024.

Di match go take place for Waldstadion for Frankfurt.

Denmark vs England Prediction

Former Premier League striker Chris Sutton say:

“Dis no Danish team no dey like Danish teams bifor, I no tink say dem go cause too many problems.

“I dey go for anoda England win, and anoda clean sheet – and I mention one pesin mention name Marc Guehi.

“I no wan say I bin get doubts about am bifor di Serbia game becos im bin do well last season, but im step up to play for im first game for a major tournament – and im play very well.”

Former England captain Alan Shearer say:

“I no fit wait [for England to face Denmark]. For 35-minutes I feel say England bin dey excellent [against Serbia]. Dem bin no too good for di second half.

“But, you fit say di same tin about Italy, Portugal and France too. No panic! England dey good position and I dey look forward to Thursday.”

Match stats

  • England neva win dia opening two matches for European Championship tournament bifor.
  • Di Three Lions bin only get 12 touches for Serbia box last Sunday, dia lowest total of touches for di opposition box for a European Championship game since 2012.
  • Only Sir Alf Ramsey (67% – 8/12) get a better win-rate among England managers for major tournaments pass Gareth Southgate (60% – 12/20).
  • England don keep one clean sheet for each of dia past five group stage matches for di Euros, na di longest of such run for di competition history.
  • Denmark don win just one of dia past six group stage games for Euros (D1 L4), dem bin beat Russia 4-1 for Euro 2020 to qualify for di round of 16.
  • Denmark complete 583 passes and enjoy 89% pass accuracy for dia 1-1 draw against Slovenia on Sunday, both na high record for di Danes wey Opta don record (since 1980) for European Championship.

Live updates of di match go start from 5pm WAT

Source