Facebook change name: Metaverse na Mark Zuckerberg rebranding – Five key info about Meta

Facebook change name "Metaverse"

Reuters

Facebook new corporate name na Metaverse – Meta in short.

Mark Zuckerberg company announce di change of dia corporate name on Thursday 28 October 2021.

Industry watchers see am as major rebranding strategy for Facebook – di parent company of WhatsApp, Instagram and Oculus VR.

Di move follow series of negative stories about Facebook, based on documents wey one of dia former employer leak. Frances Haugen accuse di company of putting “profits over safety”.

Metaverse – Five things you need to know

BBC Pidgin don breakdown five key things Facebook users need to know about Meta.

Mark Zuckerberg Facebook change name "Metaverse"

Getty Images
  1. Di change no apply to dia individual platforms, like Facebook, Instagram and Whatsapp, only di parent company name na im change – meaning e no go affect you FB account now.
  2. Facebook, as well as applications like Instagram, WhatsApp, and di virtual reality startup Oculus, go dey part of di new holding company, Meta.
  3. Dem plan to begin trading on December 1 under di new stock ticker, MVRS.
  4. Di word “meta” come from di Greek word meaning “beyond”. For Mark Zuckerberg, e symbolizes say more dey to always build, and e always get a next chapter to story.
  5. Di new name mean say over time, users no go need to use Facebook to use di company oda services. Zuckerberg say di metaverse na di next frontier in connecting people, just like di way social networking bin first dey wen e start.

‘Oda important tins Mark Zuckerberg tok about Meta’

Facebook boss Mark Zuckerberg announce di new name afta dem reveal plan to build one “metaverse” – one online world wia pipo fit play game, work and communicate for one virtual environment wit use of VR headsets.

E tok say di existing brand no fit “really represent everytin wey we dey do today, let alone for di future”, and im need to change.

“Over time, I hope dem see us as a metaverse company and I wan anchor our work and our identity on wetin we dey build towards,” Im tok for one virtual conference.

“We now don dey look at and report on our business as two different segments, one for our family of apps, and one for our work on future platforms.

“And as part of dis, time don come for us to adopt one new company brand to carry everything wey we dey and reflect who we be and wetin we hope to build.

“I dey proud to announce say as from today, our company now na Meta.”

To outsider, metaverse fit look like a version of VR, but some pipo believe e fit be future of di internet.

Instead of make pipo dey on computer, pipo for di metaverse fit use one headset to enta virtual world wey go connect all kain digital environments.

Dem hope di virtual world fit dey useful for practically anything from work, play and concerts, to socialise wit friends and family.