Who be di Nigerian Arsenal ‘wonderkid’ wey dey linked to Manchester United?

Chido Obi-Martin

Getty Images

One 16-year old footballer, Chido Obi-Martin, don break di heart of Arsenal fans around di world afta e tok say e dey leave di London-based club.

Obi-Martin, wey im papa na Nigeria but im mama na from Denmark, post bye-bye message give Arsenal fans for im Instagram to tell dem “tank you”.

“Di experience and growth wey I don achieve for here dey truly invaluable. I go always remember di memories wey we don make,” Obi-Martin write.

Unconfirmed reports tok say di youngster, wey shock evribodi last season afta e score 10 goals for one match against Liverpool U16, go continue im career growth wit Manchester United.

Man United never release official statement about dis move.

In total, Obi-Martin score 29 goals for 17 matches for Arsenal Under-18 last season.

Why Arsenal fans no happy wit Obi-Martin move?

Di tori about Chido-Obi Martin transfer no sweet plenty Arsenal fans and some of dem tok say na becos of moni.

One Arsenal fan post on X say im dey happy say di club no gree match di moni wey Man United offer di youngster.

“Im na just 16-years old and paying im 30k just like United dey absolutely crazy. We get wage structure and 15k dey pretty fair. I wish am all the best sha,” di X user wey im username na UncleYakub, tok.

But Sean Soobiya, one Arsenal fan wey share im opinion on Instagram, tok say: “Very nice for am, but no come back to Arsenal if man United no be evritin you bin tink say e go be.”

Di last striker wey Manchester United bin buy from Arsenal na Alexis Sanchez for 2018, but later for im career, di Chile striker tok say e regret di move.

“Afta my first training session, I reach house and tell my family and my agent say – ‘abi make I tear dis my contract and go back to Arsenal?'” Sanchez tok for im Instagram page for 2020.

However, Robin Van Persie na anoda striker wey move to United from Arsenal for di 2012/2013 season and e help dem win di EPL dat year.

Who be Chido Obi-Martin?

  • Im full name na Chido Obi-Martin, but dem know am as Chido Obi
  • Im birthday na 29 November 2007 – E dey just 16 years old
  • Dem born am for Glostrup, one suburb location for Copenhagen, di capital of Denmark
  • Im mama na Danish and im papa na Nigerian from di Igbo ethnic group
  • E start im football career for one Denmark club Kjøbenhavns Boldklub (KB) bifor e join Arsenal wen e dey 14 years
  • E dey eligible to play for Denmark, England and Nigeria
  • So far, e don play eight matches for Denmark U16 national team, two matches for England U16, and 14 matches for Denmark U17
  • Sake of im age (16 years), e neva dey old enough to sign professional contract, but reports say e dey join United as a free agent.
  • Apart from scoring 10 goals against Liverpool U16 side last season, Obi-Martin also score seven goals for one match against Norwich U18 as Arsenal beat dem 9-0
  • E score five hat-tricks for di last nine matches of di U18 Premier League last season

Source