‘Israel go suffer ‘harsh punishment’ for killing Hamas leader’ – Iran goment

Ismail Haniyeh

EPA
Di killing of Ismail Haniyeh don cause serious anger for across di Middle East region

Iran don threaten “harsh punishment” for Israel, as dem tok say di kontri dey responsible for di assassination of Hamas leader Ismail Haniyeh on Wednesday.

Even though Israel neva directly claim responsibility for di strike wey kill Haniyeh in Tehran, Prime Minister Benjamin Netanyahu tok say im kontri don deliver “crushing blows” give dia enemies in recent days.

E also mention di killing of one senior Hezbollah commander for Lebanon wey happen some hours bifor di Tehran strike.

Netanyahu also tell Israelis say “challenging days lie ahead”, as pipo dey fear say di katakata wey dey di Middle East now go increase.

Ismail Haniyeh

EPA

For one statement Hamas release on Wednesday, 31 July, dem say na one Israeli raid kill Ismail Haniyeh for im house for Tehran as e dey on a visit to attend di inauguration of Iran President Masoud Pezeshkian.

Hamas say dem kill Haniyeh “inside one treacherous Zionist raid”.

Israel neva respond or issue a statement.

Hamas say dia leader bin participate for di inauguration ceremony of di new Iranian President Masoud Pezeshkian on Tuesday, 30 July.

According to Iranian media, Haniyeh bin dey stay for one building for war veterans for Tehran wen di attack occur around 02:00 (00:00 GMT).

Some report suggest say na for inside air strike e take die.

Sixty-two-year-old Haniyeh, dey widely considered Hamas overall leader.

Israel neva comment, but dem bin promise to destroy Hamas afta di 7 October attack on southern Israel wey kill 1,200 pipo.

Dem bin respond wit wit a massive military operation for di Hamas-controlled Gaza Strip wey don kill at least 39,400 pipo, according to di Hamas-run health ministry.

Hamas political bureau member Musa Abu Marzuk tok say na “cowardly act” and one wey no go “go unanswered”; while anoda senior Hamas official, Sami Abu Zuhri, tok say di group go “continue on dia path”.

Iran foreign ministry tok say di “martydom” of Haniyeh go “strengthen di deep and unbreakable bond between Tehran, Palestine and di resistance,” state media report.

Several foreign ministries, including Turkey, Russia and Qatar don condemn di attack.

Israel claim say dem kill one senior Hezbolla commander Fuad Shukr.

Reuters

Haniyeh death dey come just hours afta Israel claim say dem don kill di top military commander of Hezbollah, one Lebanon-based group, wey Iran also dey support.

Israel say dem kill Fuad Shukr for inside one air strike, in retaliation for one rocket attack for di Israeli-occupied Golan Heights for di weekend.

Hezbollah neva confam say dia senior commander die for one Israeli attack for Beirut on Tuesday, but dem tok say Shukr bin dey inside one building wey dey targeted.

“Since di incident, di civil defence teams don dey work to lift di rubble gradually, but slowly, sake of di situation of di destroyed classes, and we still dey wait for di result,” one statement wey di group release on Wednesday tok.

Who be Ismail Haniyeh?

Ismail Haniyeh

Reuters
Ismail Haniyeh bin dey Tehran dey attend di inauguration of Iran new president, Hamas tok

Dem born am for one refugee camp for Gaza for 1963, Ismail Haniyeh na key member of Hamas from di time e start.

Israel bin sentence am to prison a number of times and at one point dem send am go exile to south Lebanon for six months.

For 2003, e survive one assassination attempt by Israel, along wit Hamas founder.

President Mahmoud Abbas bin appoint Haniyeh as Palestinian prime minister for 2006 afta Hamas win di most seats for national elections, but dem sack am afta one year afta di group overthrow Oga Abbas Fatah party from di Gaza Strip for one week of deadly violence.

Haniyeh bin reject im sacking as “unconstitutional”, dem say im goment “no go abandon dia national responsibilities towards di Palestinian pipo”, and dem continue to rule for Gaza.

Many pipo regard am as a pragmatist – pesin wey dey real, dem say Haniyeh maintain good relations wit oda rival Palestinian groups.

E bin dey play key role in negotiations ova one ceasefire deal for Gaza.

Haniyeh dey elected head of Hamas political bureau for 2017.

For 2018, US Department of State name Haniyeh a terrorist.

In recent years, e live for exile, and dey shuttle between Turkey and Qatar.

Hamas, Iran, Qatar and odas react to di killing of Ismail Haniyeh

Ismail Haniyeh and President Masoud Pezeshkian

Reuters
Haniyeh, left, bin meet Iran new president dis week

One senior Hamas official don vow say di group go respond to Haniyeh assassination.

Moussa Abu Marzouk bin call di raid a “cowardly act wey no go go unpunished,” according to di Hamas-run Al-Aqsa television channel.

Hamas bin claim say dem kill Haniyeh for one “Zionist raid”.

Hamas armed wing say di killing of Haniyeh go get major repercussions

Believe dey say Israel don kill several senior Hamas figures since di kasala start, wey include di deputy political leader Saleh al-Arouri and Marwan Issa, di deputy commander of Hamas military wing.

One Israeli air strike for Gaza bin kill Ismail Haniyeh three sons and four of im grandchildren for April.

Iranian President Masoud Pezeshkian don tok say im go make Israel “regret” di “cowardly” killing of Haniyeh. E add say Iran go “defend dia territorial integrity, honour pride and dignity”.

For one statement wey AFP news agency quote, di Iranian president describe Haniyeh as a “brave leader”.

Iran supreme leader, Ayatollah Ali Khamenei also say avenging im death na “Tehran duty”, e add say Israel – wey neva claim responsibility – don provide grounds for “harsh punishment”.

A reminder – Israel neva comment on weda na dem dey behind di attack.

Qatar foreign ministry describe Haniyeh death as “terrible crime, a dangerous escalation and a flagrant violation of international and humanitarian law”.

Dem warn say “dis assassination and di reckless Israeli behaviour of continuously targeting civilians go lead to di region slipping into chaos and undermine di chances of peace”.

Russia foreign ministry describe Haniyeh killing as “completely unacceptable political murder”, according to state broadcaster Ria.

Di kontri deputy foreign minister, Mikhail Bogdanov, say di Hamas leader death “go lead to further escalation of tensions”.

Meanwhile, Turkey foreign ministry also condemn di “shameful assassination for Tehran”, e tok for one statement wey Reuters quote say “dis attack also dey aim to spread di Gaza war to a regional dimension”.

Jordan say dem condemn “in di strongest terms Israel assassination” of Hamas leader – and dem say e go lead to “more tension and kasala for di region”.

China foreign ministry tok say dem “totally oppose and condemn di assassination” and dem dey “deeply concerned” about more turbulence for di region.

Wetin Haniyeh killing mean for Gaza ceasefire?

Belief dey say na Israeli jets fire rockets from outside Iranian airspace.

But while details of di attack slowly dey comot, di political consequences also dey come into focus.

Di most obvious na di likely damage e go get on di fragile efforts to negotiate ceasefire for Gaza.

Ismail Haniyeh fit no dey in charge of day-to-day events on di ground for Gaza – dat na di domain of di military commander Yahya Sinwar – but as di Hamas leader wey dey for exile, e be important pesin for negotiations wey Qatar, US and Egypt dey do.

American officials bin recently suggest say di ceasefire negotiations fit succeed soon, although one meeting for Rome last weekend no bring di desired result.

But e dey veri hard to see how dem fit make any progress afta di assassination of Ismail Haniyeh.

Source