Spain vs Nigeria 2024 Olympics match preview

Jennifer Hermoso/Rasheedat Ajibade

Getty Images
Jennifer Hermoso, Spain/ Rasheedat Ajibade, Nigeria

World Champions Spain go clash wit Nigeria for di second Group C match of di 2024 Olympics football event for Paris, France.

Dis na anoda match wey Nigerians and Africans all ova di world dey look forward to, weda somtin positive fit come out for di 11-time African champions.

Di two teams get ogbonge stars and history for different football competitions but na Spain get edge pass.

Fifa women’s World Cup Silver Ball winner Jennifer Hermoso, wey also win gold for di Fifa Women’s World Cup last year dey di team.

Jennifer Hermoso wey dey 34 years na five-time top scorer for di Spanish league top division.

Rasheedat Ajibade na Nigeria star player too, she be di top scorer for di 2022 edition of di Africa Cup of Nations.

Rasheedat wey dey 24 years dey captain Nigeria for di Olympic Games football event.

She sabi position and also get speed.

Spain beat Japan 2-1 for dia opening match while Nigeria lose 1-0 to Brazil.

Dat na di second time wey Brazil women go defeat di Super Falcons for Olympic Games. For 2008, dem also beat Nigeria 3-1.

Nigeria go need pick demsef up and go again for Sunday match wen dem go face off against current Women World Cup holders, Spain.

Brazil on di oda hand go try to qualify for di next round as dem go play Japan for dia second group game on di same day.

Head to Head

Nigeria and Spain dey meet for di first time for International football.

Sapin dey enta dis match wit evritime. Dem already get 3 points and dembe World champions.

While Nigeria get plenti work to do. Beat di Spain or dem lose, we no go give dem beta chance to qualify for di next round.

Even though Nigeria still get past glory of African champions, dem no dey too do well for international competitioms.

Wia to watch

Di match go happun on Sunday for dinSunday, 28 July for Stade de le Beaujoire, Nantes are around 6pm (Nigerian time)

We go dey update dis tori…

Source