Di eight representatives from Ghana wey dey hope to win medals for di 2024 Paris Olympics

Ghana go begin dia Paris 2024 Olympic participation on Tuesday 30 July wit Men’s 100m freestyle heat 4.

Harry Stacey na di athlete for dat heat bifor Rose Yeboah go compete for di women high jump on Friday 2 August.

For Saturday 3 August, Joselle Alice Mensah go run for di women 100m freestyle heat 6.

Later dat same day, Benjamin Azamati and Abdul Rasheed Saminu go run for di 100m race.

Despite say pipo sabi say Benjamin Azamati wey win medal for di All-Africa games fit pull im weight, sabi pipo and odas get hope for di 4×100 relay team.

Team Ghana go compete for di 4x100m relay round 1 for 8 August.

Afta di team don win di qualifying heat on 5 May 2024 – beating Nigeria and Netherlands for di world relay championship for Bahamas, expectations of di nation don rise.

Di Ghana team captain Paul Amoah tok say dem dey optimistic about dia chances.

Amoah tok di state newspaper Graphic sports, say “we dey set to do our part – hopefully our best go dey enof to bring home medal.”

Im add say “we get positive energy for here; we dey ready to compete”.

Debutants dey optimistic

Paul Amoah wit Benjamin Azamati bin dey di 2020 Tokyo Olympics wey dey reach di final for di 4x100m relay.

Even though Ghana end di final race at 7th position, officials don disqualify dem sake of some “violation”.

Dem tok say di last changeover for di relay team happun outside di changeover zone.

Di four athletes – Sean Safo-Antwi, Benjamin Azamati, Emmanuel Yeboah and Joseph Paul Amoah bin hope to win medal for dat final for Tokyo but im neva happun.

Only two of dat team bin dey dis year’s Olympic Games – Benjamin Azamati and Joseph Paul Amoah.

Di two oda athletes for di 4×100 relay for Paris na debutants – Fuseini Ibrahim and Isaac Botsio.

Team captain Joseph Paul Amoah say im dey impressed wit di spirit of di newcomers.

“I dey proud of dis boys, I neva see say dem dey nervous. Dem get positive mentality for dis games.”

Isaac Botsio dey hope for impressive debut.

“We get team work for dis squad, wey we go give our best for di kontri,” Isaac Botsio write for im social media page.

Di 24-year-old US-based athlete get one African champion medal wia im also rank inside di top 8 for di African championships.

Ibrahim Fuseini also bin dey hope say im fit dey focused for di tournament afta dia experience for di qualifying race for Bahamas.

For one of di heat for di world relay race, di baton don drop as Isaac Botsio and Benjamin Azamati bin dey change ova.

But dem put dat behind dem wia dem go on to win di final of di 4x100m relay.

Rose Yeboah na first Ghanaian female high jumper wey qualify for di Olympics

Even bifor Rose go begin to dey compete against di best high jumpers for di world for di Olympics, im already get one record.

Rose na di first female high jumper from Ghana wey qualify for di Olympics.

For di All-Africa games, Rose win gold for 2019 and 2023.

Im also win gold for 2022 Saint Pierre for di Africa championships.

Rose also win gold for di 2024 edition of di African championships for Douala.

Im also bin win gold for di world university games Chengdu 2021 wia she also win gold for di NCAA women’s outdoor track and field championship for 2024.

Rose wey dey participate for her first Olympics hope say she go make di kontri proud.

“I wan qualify for di final of di high jump, if I reach dia, anytin fit to happun,” Rose tok inside one interview for SuperSport.

Di Ghana Olympics committee bin dey quote di high jumper say im “hope to fly ova evri bar and obstacle for Paris”.

Paul Amoah and Benjamin Azamati na experienced athletes from Tokyo 2020

Joseph Paul Amoah na di team captain for di competition.

Di 27-year-old bin win bronze medal for di 2022 commonwealth games for Birmingham.

For di Africa games in March, Paul Amoah bin win gold for di 200m men’s final.

Im rank inside di top eight for di world championships once, wia im bin win silver also for di All-African games bifor.

Na im lead di relay team wey win di 4×100 final for di world relay championships for Bahamas to qualify for di Olympics.

Benjamin Azamati also bin dey win some medals.

Di 26-year-old according to di world athletics, bin dey ranked for di top eight for di world championships, wia im also win gold for di All-African games.

Im also bin dey inside di top eight for di commonwealth games.

Benjamin go participate for di 100m and di 4x100m relay for Ghana.

Abdul go compete for di 200m discipline and na im first time at di Olympics. And Edwin Gadayi go be part of di 4×100 relay team, also for di first time.

Joselle Mensah and Harry Stacey go swim for Ghana.

Team Ghana cultural statement for Olympics opening ceremony

Di Ghana team bin wear Fugu – one traditional costume for di northern part of di kontri.

Di fugu na smock wey dem take hand weave wit distinct patterns wey get cultural significance.

Dem take cotton make di fugu fabric wey dem process into threads.

Afta dem stretch di threads – dem go dye am for different colours and dry am bifor dem go begin to weave dem into strips wit hand looms.

Di fugu usually get embroidery patterns for di neck wey dey significant for di pipo of di northern part of Ghana.

For di past, pipo bin dey use di fugu for political and royal events as well as during festivals and oda celebrations.

But today, pipo fit to dey wear di smock/fugu for oda occasions.

Di Ghana Olympic committee tok say dem decide to wear fugu for di opening ceremony of di Paris Olympics to “highlight Ghana im rich heritage.”

“We also use di fugu to promote di traditional craftsmanship of our pipo for di global stage.”

Team Ghana bin wear di colourful fugu wit beads and hat for dia sail thru di Seine river for opening ceremony.

Ghanaian athletes on the sail through river seine

Getty Images
Paul Amoah and Rose Yeboah wey bin dey elected as di flagbearers for team Ghana

Ghana and di Olympics

Ghana bin dey participate for di Olympics since di first time for 1952.

Even though di kontri dey participate regularly, dem no get plenti medals to show.

Ghana don win only five medals (4 bronze and 1 silver).

Di best performance na when Ike Quartet bin win silver for di 1960 light welterweight boxing.

Di latest one na Samuel Takyi wey bin win bronze for di Tokyo Olympics thru di men’s boxing featherweight division.

Samuel Takyi

Getty Images
Samuel Takyi bin win bronze medal for di Tokyo Olympics for di men’s boxing featherweight division.

Di 20-year-old boxer at di time beat Colombian fighter David Ceiber for quarterfinal, di first medal for di kontri in 29 years.

Anoda medallist for Ghana for di history of di Olympics na Prince Amartey wey win bronze for Munich for 1972.

Clement Quartey also bin win silver for Rome for 1960, while Eddie Blay bin win bronze for Tokyo 1964.

Na boxing carry Ghana climb di podium for di Olympics four times, but for Paris 2024, di kontri no dey participate for boxing.

For dis year Olympics, Ghana present 21 representatives – wey include eight athletes and 12 officials wey include di president of di Ghana Olympic committee, Ben Nunoo Mensah.

Source