List of additional cabinet secretary nominees President William Ruto announce for nationwide broadcast

Kenya President William Ruto don announce one expanded cabinet, wey include nominees from di opposition.

During one televised address from di State House for Nairobi, President Ruto say di move to include supporters of di opposition leader Raila Odinga na to increase inclusive government.

Di kontri leader nominate additional names as cabinet secretaries and don forward dia names go Parliament for vetting and approval.

Dis dey come afta di president dissolve im cabinet, weeks afta one deadly anti-government protests wey lead to di deaths and arrest of some protesters.

E give four post to di opposition – wey include di powerful finance and energy ministries.

Dis na di first time di opposition go serve for government since Mr Odinga take up di post of prime minister for di den-President Mwai Kibaki cabinet for 2008.

Oga Ruto decision dey come as e face di biggest crisis of im presidency, as young pipo enta streets dey protest to demand im resignation under di hashtag #RutoMustGo.

Additional Cabinet Secretaries list

For inside di address to di nation, Oga Ruto say im don consult widely on forming a “broad-based government” wey go spearhead a “transformational agenda” wey go make Kenya a “better, more just and prosperous” nation.

However, protesters don reject di “broad-based” government, dem tok say wetin e only mean na deal-making among Kenya political elite.

Oga Ruto appoint 10 cabinet members in total, wey bring im cabinet to 21.

  • Roselina Soipan Tuya – Ministry of Defence
  • Aden Barre Duale – Ministry of Environment, Climate Change and Forestry
  • Salim Mvurya Mgala – Ministry of Investment, Trade and Industry
  • Rebecca Miano – Ministry of Tourism and Wildlife
  • Onesimus Kipchumba Murkomen – Ministry of Youth Affairs, Creative Economy and Sports
  • Dr Alfred Nganga Mutua – Ministry of Labour and Social Protection
  • Justin Bedan Muturi – Ministry of Public Service and Human Capital Development
  • Stella Soi Lang’at – Ministry of Gender, Culture, Arts and Heritage

Di four opposition members e nominate to head ministries na:

  • John Mbadi Ng’ongo – Ministry of National Treasury and Economic Planning
  • James Opiyo Wandayi – Ministry of Energy and Petroleum
  • Hassan Ali Joho – Ministry of Mining, Blue Economy and Maritime Affairs
  • Wycliffe Ambestsa Oparanya – Ministry of Cooperatives, Micro Small Medium Enterprise Development

Reactions don follow di appointment from some of di nominees.

Di nominee for di Secretary of Defence Soipan Tuya hail di president for her appointment.

“Upon confirmation, I go give my all, in service to di pipo of Kenya.” She tok.

Also Rebecca Miano, di nominee for Ministry of Tourism say im dey happy to get di honour, privilege and opportunity to serve her fellow kontri pipo, if goment approve.

Cabinet appointments for Kenya dey subject to parliamentary approval, something wey dey likely to happun as di two main parties don strike deal.

Oga Ruto take ova office for 2022 afta e defeat Oga Odinga inside one tightly contested election.

E promise young pipo greater economic opportunities, but e don lost considerable support among dem.

Dem force am to back down on introducing tax increases last month afta one mass protests.

Kenyans complain say dem no fit pay more taxes, wen dem dey face cost-of-living crisis and dem say widespread corruption and wastage dey for government.

Oda key points from Ruto address

William Ruto

Reuters

Asides from di announcement of additional cabinet secretaries, President Ruto also reveal seven key things im government dey do in answer to protesters demand to end corruption for government.

Dem be:

  • Proposed amendment to di evidence act and di criminal procedure code under di necessary legislative amendment, relating to corruption to expedite investigations on prosecution of corruption and economic crimes and cases and provide for dia conclusion within six months
  • Amendment to witness protection act to overhaul di statutory and institutional framework to protect and incentivise whistle blowers and enhance witness protection, to make am safer for citizens to come forward to report corruption and oda criminal cases
  • To within 90 days propose amendment to di public finance management act and public procurement and disposal act, to overhaul di institutional and operational framework of public procurement wey don dey identified as di epicentre of corruption, conflict of interest and abuse of office in di public sector, with di view of deploying digital infrastructure within di next six months
  • Engage with parliamentary leadership and ask for di conflict of interest bill to dey passed sharparly with caveat say im go veto any bill wey dem enact, if e no establish di highest bar with respect to accountability, integrity and anti-corruption
  • E say while fully respecting di independence of di national justice law and oda institutions, and pursuant to a commitment to consult and collaborate in leveraging dia institutional capabilities in effective expeditious and conclusive investigations in respect to all active cases, e dey essential for di institutions to provide timeframe for which proceedings go dey concluded and also dem go communicate di timelines to di public.
  • Di president say about 400 billion shillings dey spent on tax expenditure every year, especially on VAT refunds, process wey no always dey clear and get limited accountability. Di president say e go work with parliament within 90 days to provide a legislative and regulative framework to make di process transparent, open and accountable to reduce di huge public expenditure and direct savings from di exercise to productive sectors of di economy.
  • President Ruto say im government go work with parliament to tighten legislation to reduce and eliminate imports of goods wey dem already dey manufacture for Kenya.

Source