‘I get daughters too’ – Akpabio tell Natasha Akpoti sorry afta ‘nightclub’ comment

Nigeria Senate President, Sen Godswill Akpabio don apologise to fellow lawmaker, Senator Natasha Akpoti-Uduaghan.

Di number three pesin for Nigeria tender im apolody during plenary on Tuesday – almost one week afta e make some kain comments wey see am come under criticism by some Nigerians.

For one video wey go viral on social media on 19 July, 2024 during plenary session, Senate President Godswill Akpabio bin tell Senator Natasha Akpoti-Uduaghan wey dey represent Kogi Central say make she no tok wen dem neva tell her to tok, say “di Senate no be nightclub.”

One viral video show wetin resemble a rowdy session sake of one bill Senator Natasha Akpoti-Uduaghan try to chook mouth for di mata but Senate President Akpabio interrupt her wen she dey tok.

Inside di kasala madam Natasha say, “Mr President, we no want make di bill die, we just want change small tin sir.”

“Distinguished Senator Natasha, for dis chamber, you need to dey recognised bifor you speak,” Sen Akpabio reply her.

“Oh, abeg no vex, forgive me” Akpoti-Natasha den apologise for her response.

Afta she tok sorry, Senate president still tok say, “We no dey for nightclub.”

Na dis comment make Nigerins para for di Senate President on social media.

“Even dos of us wey don dey for di Senate for 16 years, we still dey learn and we go kontinu to learn,” di Senate president tok on Tuesday for im apology.

E say “Wen I bin dey tok to one of my distinguished sisters, I tell her to tok only wen dem recognise [allow] her.

“I bin make reference to di fact say we no dey night club wia pipo gatz shout above di noise of di music and social media went agog [carry am for head].”

Im explain say im no dey social media but im wife call am say pipo dey vex, dem publish her number and dem tok say make pipo occupy her.

Senator Akpabio say “She receive ova 2000 to 3000 calls a day, I try to on one of my phones I realise say di number dey for public, infact di phone crash afta about three hours.”

“I dey happy wit di interest wey Nigerians generate about di tins wey dey happun for dis chambers, we dey here to cater for dia interest.”

“So for dem to get interest about wetin dey happun here [Senate chambers] e mean say we dey connect wit di pipo directly,” Senator Akpabio explain.

‘Una misunderstand di communication’ – Akpabio

Di former Akwa Ibom state Govnor explain say Nigerians no understand wetin im bin mean wen im make dat comment.

Im say instead of dem to see am as a means of caution to address shouting or raising voice for di saenate chambers , dem interpret am as anoda tin.

“Dem drag di mata go private abuses. I no wan tok wetin dem do me, sake of say wetin dem do me I no deserve am. Dem list di plenti wives wey I get for social media, e come be like say di Senate president get plenty wives, but in reality na only one wife I get and I dey satisfied wit dat one.

“I no go intentionally bring [abuse] any woman, I get wife and four daughters and I dey always pray make God lift any girl pikin to di highest position for Nigeria politically and in business.

Senator Godswill Akpabio officially apologise to Senator Natasha Akpoti for di Senate chambers.

“Senator Natasha Akpoti I dey tell you sorry, if I offended you, If I bin tok say we no dey market dem for tok say I call you market woman…di way pipo jump into di mata show say you get plenti political enemies, e show say me sef get enemies sake of say all of us contest wit pipo.”

Di Senate president narrates say wit all di gbasgbos wey di statement cause for social media im feel say e dey good to tell Sen. Natasha ‘sorry’ publicly and apologise to all im colleagues too wey bin offended in any way.

Dis no be di first time di Senate President dey make dis type of comments.

Few months ago during one of di burial service for di late and former Access Bank boss Herbert Wigwe, di Senate President bin also make comments against Rivers State Governor.

Social media scata again as dem begin drag am for making dat kain sensitive comment during burial ceremony.

Source