Cut-off mark at 140 for university candidates and oda new policies from Jamb

Di Joint Admission and Matriculation Board (Jamb) don make new policies for Nigerian students wey dey apply to higher institutions across di kontri.

For dia 2024 Policy meeting for Abuja, Nigeria capital, on Thursday, 18 July, Jamb peg cut-off mark for admission into universities at 140.

Di board also tok say di minimum cut-off point mark for admission into polytechnics and colleges of education go be 100.

Nigeria Minister of Education Tahir Mamman, vice-chancellors, rectors and registrars of higher institutions and oda stakeholders bin dey di meeting.

Entry age into higher institutions

Di minister of education, Tahir Mamman, tok say 18-year-old na di required age for admission into tertiary institution for Nigeria.

Mamman tok say di 18-year benchmark dey in line wit di 6-3-3-4 system of education.

E say im position dey backed by Nigeria law wey guide admissions into tertiary institutions. Mamman say e no suppose require a statement from am for admission bodis to take dis into consideration.

“Our laws require students to dey in school from six years – Yes, e get dose wey do dat from five – and remain in primary school for six years, basic education for three years, and secondary school for three years… e no require a statement of di minister… we dey only restate wetin dey di law,” e tok.

However, afta deliberations wit vice-chancellors, Jamb registrar Professor Oloyede announce say 16 years old go be di age of consideration for 2024 academic year but e go change to 18 years from next year.

Jamb also tok say candidates gatz get NIN to create account for examination registration.

Di Board say dem go verify Direct Entry (DE) candidates bifor dem go gain admission into university and afta dem graduate from di university.

Jamb also tok say evri institution fit peg dia own university score wey dey acceptable but dem no dey allowed to reduce di Jamb minimum score for di 2024 admission year, becos dem wan make universities upgrade di scores no be for dem to downgrade di required minimum score.

Source