Watkins late goal set up Spain vs England epic Euro 2024 final

Three Lions of England

Getty Images
England celebrate late goal wey qualify dem for di final.

Di Three Lions of England don qualify for di final of di ongoing Euro 2024 championship.

England beat Netherlands 2-1 to qualify for dia second back to back final.

Netherlands open scoring for di first half in di 7th minute through Xavi Simons.

E no tey bifor Denzel Dumfries commit foul as e bring down Harry Kane inside di box.

Referee award penalty to England and Harry Kane score di penalty to draw level for di 18th minute.

Plenti action full di match for di first half.

Second half start wit more action wey see England hold possession of di ball well well.

But England get beta chance wey dem convert for added time of second half.

Ollie Watkins put di ball inside di net afta Cole Palmer give am beta pass.

Di late goal break di hearts of Netherlands and England celebrate dia victory.

England go jam Spain for di final on Sunday.

Bukayo Saka

Getty Images

Second Half

Full Time Netherlands 1-2 England

England don qualify for di final!

90+6 Match don end!

90+3 Substitution for Netherlands Xavi Dimmons don comot Brian Bobbey replace am.

90+3 Substitutions Busayo Saka don comot Ezri enta for am.

90+ 1 Xavi Simmons chop yellow card Netherlands 1-2 England

90 +1‘ GOAL! Ollie Watkins of England score! Di goal come afta Cole Palmer send di pass to Ollie Watkins wey play di ball into di bottom left corner of di post.

87’ Virgil van Dijk of Netherlands collect yellow card too for foul.

86’ Bukayo Saka chop yellow card for di foul.

86’ Bukayo Saka of England bring down im opponent, referee blow whistle and give Netherlands free kick.

85’ Denzel Dumfries of Netherlands drag di shirt of im opponent, referee blow whistle, free kick for England 81‘ Substitution for England, Cole Palmer don enta for Phil Foden. Harry Kane too don comot Ollie Watkins enta.

79’ Bukayo Saka of England put di ball for back of di net but na offside according to di linesman.

78’ Xavi Simmons of Netherlands near di edge of di box , e fire shot but e go o top of di net.

77’ Nathan Ake of Netherlands play one dangerous cross but England defebce block am.

74’ One thru ball from Xavi Simmons of Netherlands fail no reach Cody Gakpo as one of di defenders block di ball sharply.

72’ Jude Bellingham of England Donn collect yellow card sake of bad challenge on im opponen.

70’ Declan Rice of England chip di ball into di box but Bart Verbruggen block di ball sharp sharp.

69’ Netherlands get corner kick.

65’ Netherlands get corner kick and Joey Veerman play am towards goal, Denzel Dumfries play head do ball over di bar!

65’ Virgil van Dijk of Netherlands connect wit do ball for di six yard box afta di free kick wey Netherlands play, im shoot towards di right corner of goal, but Jordan Pickford save di ball.

64’ Marc Guehi of England do one yeye foul and refwere blow whistle . Netherlands get free kick.

62’ Phil Foden of England drag di shirt of im opponent but referee forgive am.

61’ Joey Veerman of Netherlands cross di ball into di penalty area but e no dey accurate enough. Di ball go out of play.

60’ Finally England lose possession of di ball as e go out of play.

59’ England still hold ball o, Netherlands just dey run follow dem upandan.

57’ England still hold ball and dem dey make short short passes wey dey sweet di belle of di English fans.

54’ Xavi Simmons of Netherlands make one solo run but im no fit create beta chance as England player block di ball. Di ball go out of play.

51’ Marc Guehi of England pass long ball to Luke Shaw but do Netherlands defence clear di ball.

49’ Bukayo Saka of England send one pass into di box but defenders clear di attemp.

48’ Dem clear di ball afta Jude Bellingham of England try to dribble im opponent , d ball comot from field and na goal kick for Netherlands.

46’ Substitution for Netherlands, Donyell Malen don comot as Wout Weghorst replace am.

46’ Substitution for England Luke Shaw don enta for Kieran Trippier.

46’ Referee Felix Zwayer don blow whistle, second half don start.

First Half

Harry Kane

Getty Images

Netherlands 1-1 England

45+4 Referee blow whistle, first half don end.

45+2 Netherlands hold possession of di ball as dem dey play short short passes to try create last minute chance.

45’ Fourth official show three minutes of added time.

45’ England dey play short short passes to hold di ball and drag Netherlands out.

44’ Jude Bellingham of England try to send one pass but dem block am.

41’ Kobbie Mainoo of England fire shot from di edge of di box, but di shot no disturb di goalkeeper as defender block di shot.

39’ Phil Foden of England get one pass e make effort from di edge of di box, but Bart Verbruggen of Netherlands go down di right to clear di ball.

37’ Jude Bellingham of England run pass all do defenders inside di box but im pass to Kieran Trippier too fast, di ball roll comot from touchline.

35’ Substitution for Netherlands, Memphis Depay no go fit play again sake of injury, Joey Veerman don replace am.

32’ Phil Foden of England control one beta pass from di edge of di penalty area but I’m shot hit di left post!

30’ Denzel Dumfries of Netherlands fire di corner kick inside di box but im header hit di cross bar.

30’ Xavi Simmons of Netherlands dey prepare to play corner kick.

28’ Jude Bellingham of England get one beta pass from Phil Foden but dem stop di ball.

25’ Kyle Walker of England play one quick thru ball to wia im teammates dey, but im dey close to di offside line, one of di defenders block di ball.

23’ Phil Foden of England fire shot from inside di box afta I’m dribble some defenders, e beat di goalkeeper too but hit one of di defenders and di ball bounce comot.

21England dey hold ball well well now

Netherlands 1-1 England

18’ GOAL! Harry Kane score di penalt!

17’ PENALTY for England! dis dey come afta dem bring Harry Kane down inside di box.

17’ Denzel Dumfries of Netherlands collect yellow card for foul.

15’ Referee dey go check VAR for possible penalty.

14’ Harry Kane of England fall inside di box afta one challenge from defender but referee wave hand for game to continue.

14’ Bukayo Saka fire di ball towards goal for inside di area but defenders block am.

11’ Phil Foden of England play one free kick into di box but dem clear am.

Netherland 1-0 England

7’ GOAL! Xavi Simmons score for Netherlands, e strike di ball into collect corner of di net.

5’ Bukayo Saka of England send one cross into di box but dem use head clear am out.

3’ Poor challenge from Jerdey Schouten of Netherlands, refer punish am as e give England free kick.

2’ Donyell Malen of Netherlands dey offside position , ref stop play afta linesman raise im flag.

1’ Referee Felix Zwayer don blow whistle and match don start.

Netherlands go face England for di semi-finals of di ongoing Euros. Dis na England second semi finals back to back for di Euros.

England performance improve against Switzerland for di quarter-finals wey make dem progress to di semi finals on penalties.

Even though Gareth Southgate side don show say dem ready come dis tournment, dem dey always put diasef for tight corner.

Netherland too no be small team – dem qualify for di semi finals afta dem beat Turkey 2-1.

Netherlands line up

BBC
England line up

BBC

Source