Kenya President Ruto dissolve cabinet

William Ruto

Reuters

Kenya President William Ruto don sack almost all di members of im cabinet wey include; all im ministers and di attorney-general.

Dis dey come afta one recent deadly protests wey lead to di withdrawal of one unpopular bill.

President Ruto dissolve di cabinet wit immediate effect on Thursday during im address for di State house.

Di dissolution of di cabinet no affect di deputy president – who e no fit fire legally , and di prime cabinet secretary wey also be di foreign affairs minister.

Di presido say im take di move afta “reflection, listening to my kontri pipo and afta “holistic appraisal” of my cabinet”.

“Even wit di progress wey we don make, I dey aware say di pipo of Kenya get high expectation from me. Recent events wey cause di withdrawal of di Finance Bill don cause many tins and afta listening to wetin di pipo tok and di performance of di cabinet.”

Ruto add, “in line wit power wey section 12 of di office attorney-general give me, I decide to dismiss all di cabinet secretaries and attorney-generals of di cabinet of Kenya.”

E neva tok wen e go name a new government.

In di meantime, e tok say, im go consult “across different sectors and political formations plus wit oda Kenyans, both in public and private”.

Di dramatic move dey highly unusual, e come less dan two years afta e take office.

Di last time dem dissolve entire cabinet na for 2005 wen di den President Mwai Kibaki sack all im cabinet members shortly afta e lose one referendum ova a new constitution.

Oga Ruto don dey under pressure from Kenyans wey don kontinu to hold anti-goment protests and dey demand for more accountability from goment, even though, e don agree to withdraw im controversial tax rises.

Some of di protesters don dey demand for di president to go.

Last week, Oga Ruto bin announce some austerity measures across various government agencies.

E also pause one proposed pay rises for members of im cabinet and parliament afta public outcry.

Why Ruto withdraw di Finance Bill 2024

For June Kenya President Ruto make u-turn ontop di Finance Bill 2024 wey cause kasala for di kontri.

One bold and new generation of young Kenyan protesters bin enta streets to force di goment to stop some of dia unpopular tax proposals.

Wetin start as anger on TikTok about one controversial finance bill change to revolution – and no be political parties organise dem.

Hundreds of protesters wey wear trainers, wey feel say Kenyans dey already overtaxed wit little to show for am, face police wey fire tear gas to march enta di capital, Nairobi.

President Ruto say im dey ready to work wit di young pipo afta di protest bin lead to di death of young pipo.

“Afta I reflect on di continuing conversation around di finance bill 2024 and listening keenly to di pipo of Kenya, wey say dem no go get anytin to do wit di finance bill 2024.”

“I concede and diafor I no go sign di 2024 finance bill and e go dey subsequently withdrawn. Di pipo don speak.”

Ruto say im go begin listen to di youths so as to know dia needs and wetin dem want.

“E dey process, sake of say we don comot di finance bill to follow young pipo tok – we go listen to dem, listen to dia needs, dia ideas and wetin dem think.”

Di president say im dey sad about di pipo wey die for di protest.

“Young pipo no suppose lose dia life. Na very unfortunate situation. Doz wey die go dey accounted for. I send my condolences to everyone wey lose dia lives for di protest.

Reduced budgets and oda tins Ruto tok

For anoda move to beg di protesters, President Ruto announce say im goment go reduce travel budgets and di parliament wit judiciary go also cut dia own budgets.

  • “I direct immediate further measures to reduce expenditure, to start wit di Executive Office of di President and extending to di entire executive arm of goment.
  • I direct say operational expenditure for di Presidency be reduced to remove allocations for di confidential vote, reduce travel budget, hospitality and purchase of motor vehicles, renovations and other expenditures.
  • I propose say make di Parliament, di Judiciary and County goment work wit di National Treasury to also undertake budget cuts to ensure say we dey do wetin we dey tok say make we live within our means.
  • I propose an engagement wit young pipo of our nation to listen to dia issues and agree wit dem on dia priority areas of concern.
  • I also propose say within di next 14 days, a multi-sectoral, multistakeholder engagement go hold wit a view to tok di way forward on matter wey relate to di content of di bill as well as strengthening our fight against corruption.”

Wetin Ruto tok ontop di finance bill protest

Some informate about di Finance Bill

VAT on bread, vehicle and sugar

Kuria Kimani wey be di chairmo of di National Assembly Finance Committee say di taxes and levies wey dey imposed for di finance bill no go dey again.

Kimani tok say di 16% VAT wey dey ontop bread go comot. E say e go lift di burden on di pipo.

Im also announce say di Kenya goment don comot di 2.5% wey dem bin dey propose to impose ontop vehicle.

Kimani also announce di removal of excise duty ontop vegetable oil. For di same statement, di chairmo say VAT ontop transportation of sugar go also dey removed.

Increase in mobile money transfers and VAT on financial services

Di chairmo of di National Assembly Finance Committee say di increase for mobile transfers no go dey again. Im tok am wen im bin dey read di statement on Tuesday.

“Increase for mobile transfer no dey,” Kimani tok.

Di VAT ontop financial services and oda foreign exchange transactions go also comot, according to Kimani.

Levies on Housing fund and locally manufactured products

Kimani say products wey be locally manufactured no go attract Eco Levy. Im add say e go help boost di manufacturing capacity for Kenya.

“Locally manufactured products wey include sanitary towels, diapers, phones, computers, tyres, and motorcycles, no go attract di Eco Levy,” Kimani tok.

Di chairmo add say di levies ontop Housing Fund and Social Health Insurance go become income tax and “e go put more money for di pockets of employees.”

Source