Five tins to know about portrait of Tinubu wey dem call ‘world largest portrait’

Federal goment unveil one big canvas portrait of Tinubu
The British Broadcasting Corporation

Artists wey bin create one big portrait of president Bola Ahmed Tinubu don tok say di idea na to serve humanity through di work of arts.

Olaore Opeyemi wey tok say im be one of di three artists wey bin create di idea tell BBC News Pidgin say dem bin come togeda to reason how dem go fit support goment for dis period of economic challenges.

Di launch of di large president Bola Tinubu canvas portrait na part of activities to mark di 25th anniversary of June 12 democracy.

Di event bin shele for Eagle square for Abuja on Wednesday.

Since di end of military rule for 1999, democracy day formerly na May 29 bifor former President Muhammadu Buhari for 2018 declare June 12 as di new date.

June 12 celebration na to honour Moshood Kashimawo Olawale Abiola aka MKO Abiola, wey dey say be winner of di June 12, 1993, presidential election.

Dem claim say na di biggest portrait in di world but Guiness World Records gatz verify dat claim.

For di painting, Tinubu bin wear one wine-colour agbada and im signature cap wit beads for im hand and neck.

Di size of di portrait na 32 by 64ft, according to Olaore Opeyemi one of di three artists wey own di work.

Olaore tok say di category of di project neva dey Guiness World Record and dem neva give dat award bifor.

For now, na award of di largest painting for di world dey di Guinness World Records website, sometin wey Olaore tok say dey different from dia own art work.

Di painting bin measure 12,086.59 m² (130,099 ft²) and e dey completed by Hung Chi-Sung (Chinese Taipei) for Hualien, Chinese Taipei, on 21 June 2019.

Tins you need sabi about di canvas painting

  • Di idea of di canvas portrait bin come from three artists. And e bin take di artists eight months period to fit complete am.
  1. Jinadu Toyin
  2. Adele Oladipupo
  3. Olaore Opeyemi

Na Jinadu Toyin wey own Artifact Galleries wia dem do di portrait be di leader of di group, Olaore Opeyemi tok.

Olaore na staff of di national council for arts and culture.

E bin explian to BBC News Pidgin say na di three of dem get di work but only contract di oda artists to paint am.

  • Na 37 artist bin come togeda to paint di portrait wey dem say be di world largest- Di claim neva dey verified by Guinness World Record.
  • Di size of di portrait na 32 by 64ft
  • Sake of di size e fit dey erected for one resort centre, Olaore add.
  • “Di portrait neva dey certified but Guinness Book Of Record no get dat category of record for dia record book/archive”.

We don apply but di job neva dey certified, Olaore further tok.

“Apart from Guinness World Records, we don also notify International book of records and World wide records for India as dia own too na ogbonge recognition”.

  • Dem go need pay some moni wey reach thousands of dollars to GWR and oda world record as administrative charges bifor dem finally certify dia work, e tok.
  • Di aim na take di project raise money for Nigerians through govnors of different state.
  • Olaore tok say dem go make public any amount wey dem see and go publish names of pipo wey benefit for Newspapers.

Source