Lagos okada ban, Nigerian states wey do same

Lagos okada ban latest update:

Getty Images

Lagos okada ban don take effect for Nigeria commercial capital.

Meaning, commercial motorcycle aka ‘Okada’ no fit operate for parts of Lagos.

However okada na fast means of land transportation for big cities like Lagos wia traffic palava no be your mate.

But di ban na for six out of di 20 Local Goment Areas don happun for oda states.

So, yes Lagos no be di first state wey go ban okada for Nigeria.

In fact di ban on okada na sometin wey states across Nigeria don do before.

Still on still, Okada ban go affect flexible movement inside di ever busy affected areas for Lagos.

Reasons why goments dey ban okada

Lagos okada ban latest update:

Getty Images
Okada riders for Lagos, Nigeria commercial capital

Di latest Lagos okada ban affect local goment areas na Eti-Osa, Apapa, Surulere, Lagos Mainland, Lagos Island and Ikeja di state capital.

Most times goment dey take di decision to ban okada sake security concerns.

Na one of di reasons wey also make Lagos begin enforce total ban on dat means of transportation.

Over di years, some okada riders don involve for deadly fight-fight wia dem dey operate.

Even jaguda pipo, armed robbers, kidnappers and even terrorists dey use okada operate.

Some passengers don also die sake of rough riding by okada riders.

Dia activities don cause deaths and life threatening injuries.

Nigerian states wey don ban okada like Lagos

Nigeria get 36 states but na only few of dem don ban okada.

Rivers state na one of d first states of di federation wey ban di use of okada.

Na former govnor Chibuike Rotimi Amaechi impose di ban for 2008.

Dat time na wen di state dey dey battle wit insecurity sake of militant activities for Port Harcourt di state capital.

Kano state goment ban di use of okada from di capital.

Na Kano road traffic agency make di announcement for 2017.

Goment impose di ban at di height of Boko haram attacks for di North western state.

Akwa Ibom state ban di use of okada for di state capital, Uyo for 2011.

Di den govnor Godswill Akpabio ban motorcycle for Uyo to make way for di urban renewal policy of im goment.

As a way of encouraging di okada riders di govnor promise to pay N50,000 per okada to alleviate di condition of di riders.

Abuja, Nigeria Federal capital territory, ban di use of okada for 2018.

Di FCT administration say di Abuja master plan no make provision for okada and keke, wey be tricycle to operate for di capital city.

Enugu state na one of di first states for Southeast Nigeria wey ban di use of okada.

Goment announce di ban for 2011.

Dem say di ban dey in line wit di Enugu state traffic law Act (137) of 2004.

Kaduna state for Northwest Nigeria ban okada for di city centre for 2014.

Di ban take immediate effect afta former govnor Mukhtar Yero sign di Kaduna State Commercial Motorcycles Prohibition Law.

E say na sake of security challenge wey dey affect di state.