Court remand Osinachi husband for Kuje prison

Di Federal Capital Territory High Court, Wuse, on Friday, 3 June, 2022 ask authority to lock Peter Nwachukwu, husband of di late gospel singer, Osinachi, for Kuje Correctional Facility pending wen dem go hear di homicide case against am.

Justice N.K. Nwosu-Iheme give di order on Friday afta Osinachi husband plead not guilty to di  23 count charges bordering on domestic violence and homicide wey goment bring against am.

Di office of di Attorney-General of di Federation and Minister of Justice file and allege say Peter forcefully drive Osinachi from her matrimonial home and dat act dey contrary to di Violence Against Persons, VAP (Prohibition) Act, 2015.

And dat e forcefully push di gospel singer out of a moving vehicle.

Justice Nwosu afta dem arraign Nwachukwu before am fix  June 16 from 12pm and June 17  for accelerated hearing and di court case go start for 9 am.

 

Di Case Against Osinachi Husband

Di goment charge Nwachukwu say e allegedly commit culpable homicide under sections 104 and 379 of di  Administration of Criminal Justice Act, 2015,

Di offence dey contrary to section 221 of the Penal Code and punishable wit death.

FG allege say di defendant deprive Osinachi her personal liberty as e restrain her movement and lock her up for  house.

Goment accuse di  defendant say e subject di late Osinachi to emotional, verbal and psychological abuse, contrary to section 14(1) of the VAP Act, 2015.

Di  defendant deny  Osinachi access to her moni to go hospital and use for  household necessities and force her to dey beg and borrow.

Dat Osinachi husband forcefully isolate and separate her from her family by preventing her mother and siblings from visiting her matrimonial home.

Nwachukwu allegedly beat-beat her pikin dem and record dia cry and play am for im phone.

Dat e prevent im pikin dem make dem no report  di acts of domestic violence against dia mama.

“Di business for today na arraignment, I hereby order accelerated hearing”  Justice Nwosu-Iheme tok

Nwachukwu wife die for April 8, 2022 and many of her colleagues bin accuse her husband say e dey treat her anyhow (domestic violence) wey lead to her death.

Di Nigeria Police arrest Nwachukwu and e don dey detention since den before im arraignment today.