How cost of dialysis for Ghana dey worry patients wit kidney failure

The British Broadcasting Corporation

Ova one thousand patients wit kidney disease for Ghana dey fear say dem go die.

Various public hospitals don increase di cost of dialysis from $26 to $33 per session.

Patients dey need 2-3 sessions evri week. Some now dey do one session per week, or once evri two weeks.

One of dis patients na Mercy Mensah, wey tell BBC News Pidgin say sometimes she no dey go for dialysis if she no get moni.

“Dem say I gatz do transplant. For now, I suppose dey for dialysis until I get di moni for di transplant,” she tok.

Di goment thru di national health insurance authority (NHIS) announce say dem go offer free dialysis to patients below 18 and dose above 60 years.

Di goment go pay di cost of two out of eight sessions per month for patients between 19 – 59 years.

Di patients wan make goment make di sessions free for all patients.

Sabi pipo fear say more pipo go suffer kidney wahala sake of lifestyle habits and oda tins.

Dis pipo wey dey battle for dia lives dey live one day at a time

Many of dem use all dia savings to pay for dialysis for 8-10 years.

Average cost of kidney transplant be $60k – $100k – dis patients no fit to afford.

Some of dem – as young as 6,7,8 years go dey on dialysis for di rest of dia lives. Some of dem don die already dis year.

Source