Why family of Kenya man wey die for Mt Everest dey leave behind im deadi-bodi wey go cost $190,000 to bring down

Di deadi-bodi of one Kenyan climber wey die on Mount Everest last week go remain on di mountain wia e die, im family tok.

Joshua Cheruiyot Kirui bin die while im bin dey on a daring mission to reach di summit of Mount Everest witout extra oxygen.

Di 40-year-old mountaineer bin fall into a crevasse just about 48 metres (160 ft) below di 8,849-metre peak, along wit im Neplai guide.

Kirui family tok say to retrieve im bodi from such a high altitude go dey too risky for di rescue team.

Climbing Everest, di world highest peak, dey considered extremely difficult and risky, even for experienced climbers.

Kirui bin dey try to become di first African to climb Mount Everest witout extra oxygen – one Nepali climber Nawang Sherpa bin accompany am.

Nawang still dey miss.

For one statement on Wednesday, 29 May, Kirui family tok say dem don take di “difficult” decision to let im deadi-bodi rest on di mountain afta wide consultations and “careful consideration of all di circumstances”.

“To retrieve im bodi from dat high up go dey risky for di rescue team, di family no wish to endanger any life,” di statement tok.

“Cheruiyot bin get deep love for di mountains and dem love am in return. We find solace to know say im dey rest for im happy place,” di statement add.

Di family, however, tok say memorial services go dey for di capital Nairobi and for im Chepterit village, for Rift Valley region.

Concerns also dey about di cost of retrieving his bodi to dey buried back home.

E go cost about $190,000 (£150,000; N274,698,200) to retrieve im bodi and e go take about eight people to scale up di mountain to carry out di mission.

Most families wey lose dia loved ones on Everest prefer to leave dem dia.

E dey estimated say di bodis of nearly 200 of di 330 climbers wey don die on di world highest mountain remain dia.

Di climb by Kirui wey be banker bin generate interest for Kenya and fellow climbers bin post frequent updates about di attempt online.

Bifor im fatal climb, Kirui bin tell di BBC say im bin undergo extensive physical preparations ahead of di challenge.

For im latest Instagram post, im bin express confidence say im fit conquer Everest witout additional oxygen.

He however tell di BBC say im get emergency oxygen support from Nawang and emergency evacuation cova in case im run into difficulties.

Most pipo climb Everest for April and May wen weather conditions dey most favourable.

Four climbers don reportedly die so far dis season, wey go end in a few days.

Source