Nepal Plane crash: Rescuers find 21 dead bodies from site

Di remains of di plane

Getty Images
Wetin remain ofdi Twin Otter aircraft, wey dey operated by Nepali carrier Tara Air, dey scattered on di mountainside for Mustang one day afta e crash

Rescuers don find 21 bodies so from di crash site of one plane wey go down for northern Nepal.

Di small plane bin dey carry 22 pipo, and di search continue to find di remaining missing passenger.

Dem recover di remains of di plane, wey dey operated by Nepali carrier Tara Air, for di district of Mustang for northern Nepal, according to one Nepal Army spokesman.

Di passenger plane bin dey on a 20-minute flight wen e lost contact with air traffic control five minutes before e bin dey due to land.

Four Indians, two Germans and 16 Nepalis bin dey on board di plane, according to reports. But search operations no flow well becos of bad weather and di mountain terrain, and dem only resume on Monday morning.

Fotos wey dey posted on Twitter by a spokesman from di Nepalese Army show di remains of di plane – wit di registered call sign 9N-AET.

“Search and rescue troops don physically locate di plane crash site,” Narayan Silwal tok on Twitter.

Di plane bin depart di tourist town of Pokhara around 0955 local time on Sunday (04:10 GMT). E bin dey bound for Jomsom – One popular tourist and pilgrimage site.

Nepal get some record of aviation accidents, often due to di sudden weather changes and airstrips wey dey located for rocky terrains wey dey difficult to access.

For early 2018, one US-Bangla flight carrying 71 pipo from Dhaka for Bangladesh catch fire as e land for Kathmandu, killing 51 pipo.

More recently, three pipo die inside plane crash for April 2019 wen di aircraft comot runway and hit one helicopter wey park for Lukla Airport – e dey considered to be one of di most tricky runways to navigate.

Pipo die wen one plane carrying 71 pipo crash near Kathmandu airport for Nepal in 2018.