New York Governor Andrew Cuomo resigns: Kathy Hochul go takeover, Cuomo explain resignation

Cuomo quits and addresses daughters in resignation speech
The British Broadcasting Corporation

New York Governor Andrew Cuomo don resign afta of harassment report.

Investigation show say Cuomo sexually harassed multiple women, provoking efforts to remove am

“Di best way I fit help now na if I step aside and let goment get back to governing,” New York Govnor on Tuesday.

Cuomo resignation go take effect in 14 days.

New York Governor Andrew Cuomo resigns: Kathy Hochul go takeover, Cuomo explain resignation

Getty Images
Andrew Cuomo

Power go then transfer to Lieutenant Governor Kathy Hochul.

Why Andrew Cuomo resign?

Cuomo, age 63, bin faced rising pressure to resign since last week report, including from President Joe Biden.

On Monday, one of di 11 women wey accuse New York Governor of sexual harassment don reveal hersef for di first time.

Brittany Commisso, wey be Executive assistant to Governor Andrew Cuomo, go on television wia she ask for justice.

Brittany Commisso tells CBS This Morning: “He groped me, he touched me”
The British Broadcasting Corporation

Oga Cuomo, deny di accuse before im resign.

But say im want to “deeply, deeply” apologise to any women wey fit don dey offended by im actions.

“In my mind I never cross di line wit anyone. but I no realise di extent to which di line wey dom don redraw,” di New York Govnor tok.

E add say im inner gut feeling na “to fight through dis controversy, because I believe say e dey politically motivated”.

But he say im dey resign because di “current tori” of di scandal go generate months of distractions and “cost taxpayers millions of dollars”.

New York Governor Andrew Cuomo resigns: Kathy Hochul go takeover, Cuomo explain resignation

Reuters

Mr Cuomo tok say di allegations don harm im relationship wit im girl pikins [daughters].

“I don seat on di couch wit dem, hearing di ugly accusations for weeks.

“I don see di look in dia eyes, and di expression on dia faces. E dey hurt,” he tok.

Who be Cuomo replacement?

Kathy Hochul go become di first female govnor of di fourth most populous US state.

Di 62-year-old na Democrat from di Buffalo area of New York state.

She joined di govnor team in 2014, and don occupy mostly ceremonial role of lieutenant govnor.

New York Governor Andrew Cuomo resigns: Kathy Hochul go takeover, Cuomo explain resignation

Getty Images
Kathy Hochul

She bin no dey part of Cuomo inner circle, but him describe her on Tuesday as “smart and competent”.

Ms Hochul bin join di chorus of politicians wey publicly declare last wee say New York governor do wrong.

And she say Andrew Cuomo resignation on Tuesday na di “right thing to do”.

“As someone wey don serve at all levels of government and is next in the line of succession.

“I dey prepared to lead as New York State 57th Governor” she tok inside one statement.