Women cry out ova how poor electricity dey affect dia sexual life

Some Nigeria women gada to protest di lack of power supply for dia area as dia husbands no dey gree make love to dem sake of heat wey dey inside house.

Early mor-mor on Tuesday, di angry women gada in front of Port Harcourt Electricity Distribution Company to begin shout “our husbands no dey touch us again becos of heat.”

Di protesters carry placards wit inscriptions wia dem write; “No light, no bill”; “Dim street no get light”; “No light, no payment”; “Di heat is too much”

Dem dey complain ova dia daily struggle sake of di financial burden wey di power cut dey cause for dia life.

For many households in Nigeria power cut don force families to begin rely on petrol to power dia generator and solar so dem go fit preserve dia foods.

Di protesters explain say di power cut don ruin dia marital life – dem accuse di power distributing company say dem dey supply “darkness instead of light.”

On 25 January, 2024, di Transmission Company of Nigeria (TCN) around 11:00 am, issue one memo for dia X page say dem don start di gradual reduction of power transmission to distribution companies nationwide sake of gas shortage.

Black out

BBC

TCN explain say di load of di grid don reduce becos na wetin dem dey fit generate dem go transmit to distribution companies.

“TCN dey committed to ensuring gradual increase in electricity supply to load centers as gas improve to power available thermal plants,” TCN tok.

“Please bear wit us as we kontinu to dey work wit di stakeholders in di value chain to ensure supply through distribution companies to electricity consumers nationwide improves.”

On 29 May, 2023, di current administration remove fuel subsidy, dis move na to save di struggling economy but dis don dey affect businesses wey dey depend on fuel to run dia business across di kontri.

Blackout for Nigeria don become regular occurrence for some parts for di kontri.

On February 4, 2024, di system capacity of 2,407 megawatts bin reduce to 31megawatts and lata 0megawatts.

Dis na sake of di national grid wey collapse dat day. Transmission Company of Nigeria (TCN) confam am.

Many distribution companies bin tell dia customers say di blackout wey happun to dem na sake of di collapse of di national grid.

Black out

Getty Images

Benin Electricity Distribution Company (BEDC) wey dey supply electricity give Delta, Edo, Ekiti and Ondo state bin announce give dia customers say dem get limitation for allocation and e dey beyond dia power to control.

For Lagos, di Eko Electricity Distribution Company EKEDC), wey be one of di distribution companies for di kontri, bin tell customers say dem no dey get enof allocation again.

Dis na sake of say shortage of gas bin dey from di company wey dey supply electricity.

For many parts of Lagos like Ikorodu, dem dey rotate di time way wey dem go bring light. Wen one street or area get light today, dem gatz wait for di anoda day and most of di light no dey take too long bifor dem take am.

Likewise, Isheri area of Ojodu-berger, di residents don complain of how poor electricity bin dey affect dia businesses.

Several soft drink sellers say dem dey spend heavily to buy iced block wey dem dey use make dia drinks cold bifor dem go fit sell am.

Frozen foods also dey affected as wit di total blackout wey dey hit di state as many of dem gatz dey reduce di way wey dem go dey buy items like fish to dey resell since light no dey to preserve am.

Na different parts of Lagos dey affected by power outage.

Source