Nigerian Ike Ekweremadu and im wife chop arrest for UK ontop accuse of organ harvesting charge

Former Nigerian Deputy Senate President Ike Ekweremadu and and im wife Nwanneka Ekweremadu don chop arrest for UK sake of accuse say dem conspire to arrange to take one one child to UK for organ harvesting.

60-year-old Ekweremadu and im 55-year-old wife chop di arrest afta investigation by di Metropolitan Police Specialist team.

Met Police tok for inside one statement wey dem share wit BBC Pidgin.

“Beatrice Nwanneka Ekweremadu, 55 (10.9.66) of Nigeria dey charged wit conspiracy to arrange/facilitate travel of anoda pesin with a view to exploitation, namely organ harvesting.

Ike Ekweremadu, 60 (12.05.62) of Nigeria dey charged with conspiracy to arrange/facilitate travel of anoda pesin wit a view to exploitation, namely organ harvesting,” di statement tok.

Met Police say dem don remand di suspects for custody and dem go appear for Uxbridge Magistrates’ Court later today.

Dem launch di investigation afta detectives dey alerted to potential offences under modern slavery legislation in May 2022.

Di Met Police say dem don safeguard di child and dem dey work closely wit partners for more support.

Dem no give di gender of di child wey di suspects won harvest im organ.

“As criminal proceedings don dey go on, we no go provide further details,” di Met Police tok.

Who be Ike Ekweremadu?

Nigerian Ike Ekweremadu and im wife chop arrest for UK ontop accuse of organ harvesting charge

Ike Ekweremadu/Facebook
Ike Ekweremadu and im wife chop arrest for UK

Ike Ekweremadu na former Nigerian Deputy Senate President.

Di lawmaker na ogbonge politician for Nigeria and im don dey Senate since 2003.

Ekweremadu na from Enugu State and im serve as di Deputy Senate President for 6th, 7th and 8th Senate.

Di Senator hold both bachelor’s and master’s degree in law from di University of Nigeria and dem call am to bar in 1987.

Im also hold Doctor of Philosophy degree in law from di University of Abuja.

Di politician belong to di opposition People’s Democratic Party (PDP).

Ekweremadu bin get di ambition to contest for di 2023 governorship election for Enugu but im withdraw from di PDP primaries hours before di election.

Di politician tok say im bin make plans and develop strategies to transform di state but some pesins work against am.