How di release of Israeli hostages and Palestinian prisoners dey sweet pipo

Seventy-nine-year old Channah Peri na one of di 24 Israeli hostages wey get back dia freedom today but e go be bitter sweet.

Dis na as her pikin wey dem follow kidnap, Nadav Popplewell, 51, neva get im freedom yet and 54 year old pikin Roi bin dey killed on 7 October.

Her pikin Ayelet Svatitzky follow BBC tok last month about di kidnap and she tok say dem carry di two hostages from dia house. Before sending pictures for di mama phone as dem write under say Hamas.

Dis be like di tori from oda hostages wey Hamas gbab for dia 7 October attack enta Isreal. Tori be say dem gbab about 240 hostages for di attack.

Israel tok say Hamas release 24 hostages wey include 13 Israeli citizens and 11 foreigners and di nationals include:

Asher family: Doron Katz Asher (34 years old), Raz Asher (age four) and Aviv Asher (two years old)

Aloni family: Daniele Aloni (45 years old) and Emilia Aloni (age six)

Monder family: Ruth Munder (age 78), Keren Munder (54 years old) and Ohad Munder (age nine)

Adina Moshe (age 72) – Hanna Katzir (age 76) – Margalit Mozes (age 77) – Channah Peri (age 79) – Yafa Adar (85 years old)

Di foreign hostages include Ten Thai hostages and one Filipino.

Red Cross bin carry di hostages from Gaza enta Egypt through di Rafah border crossing.

Di Israel Defense Forces don confam say di released hostages don enta back Isreal.

As part of di deal wey Qatar help arrange, dem go don also release 39 Palestinian prisoners for Israel jails today.

Under di terms of di deal, dem suppose release total of 50 hostages and 150 Palestinian prisoners ova di next four days for di temporary cease fire.

Di agreement still allow more aid to enta Gaza, dat na 60 lorries wey go carry medicine, fuel, and food enta from Egypt today.

Palestinian Man dey hold flag

Reuters
One of di Palestinian detainees wey dem release dey siddon for pipo shoulder

Meanwhile, for di West Bank, pipo bin start to dey hala as plenti pipo gada di Red Cross motor for di Beitunia.

Di 39 Palestinian detainees bin dey expected to enta from dis checkpoint.

Di crowd wey full around di car just dey hala say “Where di prisoners? Where di prisoners?!”

Dem bin transfer di pipo wey dey due to be released go di Ofer prison for West Bank today in preparation for di release.

Di bus just enta through di West Bank with di prisoners as Palestinians supporters just dey celebrate.

For windows, some prisoners just dey dance as one even wear Palestinian flag.

Outside dem comot phone dey jolly and shout welcome to di released prisoners.

Some pipo for crowd carry Hamas flag, but odas say na Palestinian unity be di koko tonight.

Tori bin come say di release bin dey delayed sake of kasala between some Palestinian men and Israeli forces.

Qatar say na 39 women and pikin dem release from Israeli prisons dem.

Dem be 24 women and 15 teenage boys.

Wetin be di update on di Israel-Hamas War?

One senior adviser to di Israeli Prime Minister tell BBC di release of hostages dey bittersweet.

Mark Regev say e dey “veri happy” for di released hostages but most of dem still dey for Gaza under Hamas hand.

E add say Israel ready to increase di four day cease fire if dem release more hostages.

But e say las-las di kontri go continue dia military operation for Gaza.

Regev add say im believe say di reason Hamas release hostages na “sake of say dem dey under military pressure.”

Source