George Floyd protest: More pipo still dey do I no go gree for America

Protesters for New York City's Brooklyn, 2 May 2020

Getty Images

Tens of thousands of pipo don demonstrate, mostly through peaceful protest, across America for di eighth night afta di death of African-American George Floyd for police custody.

Floyd relatives join one of di biggest protests wey happun for im hometown for Houston, Texas.

Many bone curfews for several cities, wey dem put in place afta violence and looting for some districts on Monday night.

For central Washington DC, police fire tear gas late into di night.

Dis na as military enta street for di capital and helicopters fly above di protesters as dem dey march towards dii White House.

One video wey go viral show Derek Chauvin as im knee ontop George Floyd neck re-awake di anger of pipo over di way police dey kill black Americans.. He and three oda officers chop sack over di incident.

Dis wahala don lead to days of protest now around America and kasala wey di kontri never see for years.

Di officer, Derek Chauvin dey under arrest and don dey charged with third-degree murder and manslaughter and go show for court next week.

Man kneel and raise im fist for one memorial site

Getty Images

Floyd death bin cause protest, katakata for di state, afta di third night of protest for Minnesota and Minneapolis, di governor of di state Tim Walz say di katakata wey dey happun na sake of generations of pain wey black pipo don endure for United State.

For international press conference, Govnor Walz say dem need to restore order to our society before we go fit solve di problem wey we get.

First tin wey Oga Walz tak start di conference na , “di chapter wey dem write dis week na one of our darkest chapters.”

Im add say di whole world dey feel di pain and emotion of wetin happun.

Map of di protests as e dey happun

BBC
Map of di protests as e dey happun for America ontop George Floyd death

Wetin don happun since George Floyd die?

  • Authorities don declare as murder, di death of George Floyd wey cause ogbonge protests across America for inside one official post-mortem examination.
  • Di 46-year-old suffer cardiac arrest as Minneapolis police bin deey hold am for ground, di report tok. E list Mr Floyd cause of death as “cardiopulmonary arrest complicating law enforcement subdual, restraint, and neck compression”.
  • President Donald Trump vow to use military to end di protests.
  • Mr Floyd family bin demand say di four police officers wey get hand for im death must face murder charges. Authorities bin say dem still dey gather evidence.
  • Authorities fire di four policemen wey involve for di incident, Derek Chauvin, Tou Thao, Thomas Lane and J Alexander Kueng and di mayor call for criminal charges against di officer wey di video show dey knee ontop Floyd neck.
  • Police for Minnesota arrest one CNN journalist, Omar Jimenez and im camera crew wey bin dey live on air, say dem no move wen dem ask dem to. Dem later release di team one hour later afta di govnor tok sorry for im arrest.
  • More dan 75 cities don see protests ontop wetin happun to George Floyd.
  • Demonstrations don happun for oda cities aside Minneapolis, for New York, Los Angeles, Chicago, Denver, Phoenix , Memphis, Denver, Colorado and for Columbus, Ohio. since Floyd die.
  • President Donald Trump don threaten to send military to end di protests.
  • Officers don fire tear gas and rubber bullets to pursue crowd. But protesters set fire put for di police station, wey near wia Mr Floyd die.
  • Di chief of Louisville Police for Kentucky chop sack afta law enforcement shoot into crowd and kill di owner of one nearby business.

Wetin happen to George Floyd?

Officers wey bin dey respond to reports of di use of fake money bin approach Floyd for e car.

According to police, dem tell am to move away from e car but e no gree make dem arrest am.

Police for statement say: “Officers bin dey able to handcuff di suspect and come see say im dey suffer from medical distress.”

Di video wey passer-by take for di scene no show how di confrontation happun but show how one white police officer use e knee to pin Floyd neck to di ground.

Floyd tok say “abeg, I no fit breathe and “no kill me” as im lie down for ground.