All you need to know about di Tyson Fury v Francis Ngannou big fight

Fury and Ngannou

Getty Images

Tyson Fury dey take break from im heavyweight world-title duties wen e face MMA star Francis Ngannou on Saturday for Saudi Arabia.

Di Briton go meet di Cameroonian French UFC heavyweight champion Ngannou for di word of boxing as di non-title heavyweight fight go dey overseen by di British Boxing Board of Control.

Ngannou, 37 na ogbonge underdog on top di unbeaten WBC champion but Fury belt no dey on di line for dis fight.

Fury say di world suppose “laugh” am if e lose.

Dis match dey seen as Fury preparation match before im face Ukraine boxer Oleksandr Usyk for December for unification match.

But pipo don say on a normal day Ngannou no reach to be Fury sparring partner sef.

Dis na as Usyk get di three oda belts for di division for match wey go happun for di same Riyadh, Saudi Arabia.

Dis no go be di first time boxers go crossover to fight wit anoda sport fighter.

For 26 June 1976, Muhammad Ali bin face Japanese wrestler Antonio Inoki but di fight fall into confusion as di rules no too clear and di match end in draw.

Six years ago sef wen Floyd Mayweather jam UFC Connor McGregor na Mayweather last fight.

But both Fury and Ngannou dey at di peak of dia powers.

So na for Ngannou to show why e deserve di fight and make Fury fight no put di whole sport to shame.

Predictions from Boxing and MMA sabi pipo

Fury and Ngannou

Getty Images

UFC heavyweight Tom Aspinal say, “I tink say Ngannou get chance. Na heavyweight and dem dey punch very hard especially pesin like Ngannou. But as far as chances, e dey slim. I tink 99 times out of 100, Fury go school am.”

Two weight boxing world champion Natasha Jonas say, “If I be Tyson manager and in dey advise am, I go say make you get some rounds. Every once in a while gove am well and show am real boxing. Say you be di daddy. You be di king od di ring”.

Former boxing world champion Joe Calzaghe say “I think Tyson Fury afta a few rounds. Maybe for two rounds e go jab and move but by round three or four.”

UFC fighter Lerone Murphy say, “Tyson Fury go outskill am by far. I tink na very different game and for big gloves. I no know if Ngannou go fit carry di same kain power.”

BBC 5 Live Boxing analyst Barry Jones say. “Francis na di best ofr wetin im dey do for im weight for im spot. But dat no be boxing. Tyson na di clear number one for di division and no dey get too much wahala with di best active boxer, so to get wahala with pesin wey never box before dey one kain. I feel say Tyson go use Ngannou play and then finish am for later rounds or im go all out early and comot am as early as e fit. Di only question be how good be di chin of Francis Ngannou.”

Bellator fighter Leah McCourt say “E dey hard to bet against Tyson Fury but Francis ma true champion wey don do di impossible before. E look like e don dey prepare in every way im fit for dis fight. Wetin I go like see na make dem carry some of dis boxers enta MMA cage sha.”

Former UFC heavyweight champion Junior dos Santos say, “E do me great show but I see Tyson Fury say e go do wetin e dey do best, moving round, throwing jabs and small-small e go take di fight. But I dey stand befind Francis Ngannou. Of course I want make di MMA get dia first victory ova di boxing world. E get di power, e fit be di hardest hitter ever for MMA. We get little chance so make we go for am.”

Who be Francis Ngannou?

Francis Ngannou

Getty Images

Dem born Ngannou for Batie Cameroon for inside poverty so e start to dey work as pikin. At di age of 12 na for inside sand quarry di man dey work.

But im papa inspire am to become street fighter for di yard and na from there e start to ginger im fight career.

At di age of 26, Ngannou use di sea route to enta France. E reach Paris and bin stay as homeless pesin as e dey ginger pipo wit im fighting career

E say, “boxing na my first love ever since I fit remember.”

But di 37 year old don reach di top of im sport to become di UFC heavyweight champion with 16 stoppages for di 17 wins im get.

Source