Who be Ilebaye, di 22-year-old wey win BBNaija All Stars season

She be di one wey pipo no see dey come.

Afta 70 days, Ilebaye Odiniya, wey pipo dey call di “Genz baddie” win di Big Brother Naija reality TV show, All Stars edition for 2023.

Di 22-year-old be di youngest housemate for di house compete against 23 oda housemates, wey some of dem be strong contenders both outside and inside di Biggie house.

You fit call her di underdog for di season.

During her time for di Big Brother Naija Level Up Season 7 she chop eviction for di third week of di show.

So who for tink say she go not only reach di final week dis time, in a show wey she compete with oda housemates wey not only get great influence, platforms and fanbase but say she go be di first winner of di All Stars edition.

To put tins in context, wia Ilebaye followers no reach one million for Instagram, Mercy, di first runner up followers reach four million as at di time of filing dis report.

On Sunday, Ebuka Obi-Uchendu wen di host of di show announce ontop stage say na Ilebaye win di reality TV show, wit di highest vote of 30.08%, while her strongest contender wey be di winner of BBN of 2019 edition “Pepper Dem”, Mercy Eke get 23.48% vote as first runner-up, di moment come as a welcome news and gladden di hearts of her fans wey she win in di course of di show.

So how she manage do am?

Most pipo generally dey like di underdog story. And for Baye, tins also just line up for her dis time.

During di 70 days run of di show, Ilebaye give viewers some interesting highlights inside Biggie house as she dey jolly and sometimes enta middle of controversies for di show.

During di show, she collect two strikes for fighting Cynthia Nwadiora wey pipo sabi as CeeC and choking Doyin during argument. Biggie come give am two strike, Ceec one strike and warn Doyin.

Biggie ban both Ilebaye and CeeC from head of house game for dat week and dem both face nomination for possible eviction, wey dem survive.

She also get some oda issues with oda housemates wey just continue to make her fans outside push and fight harder say di ‘underdog’ must win.

Who be Ilebaye Odiniya?

Her name na Ilebaye Precious Odiniya, she be from Igala tribe from Olamaboro local government area in Kogi State.

She graduate from Salem University, Kogi State, wia she study Criminology and Security Studies, before she come start modelling career.

Dem born her for 2001.

Ilebaye from a young age don feature inside TV dramas by Wale Adenuga Productions, as she appear for “Papa Ajasco,” “Super Story,” and “Nnenna and Friends”.

Di 22-year-old reality TV show winner, dey among di housemates for BBNaija ‘Level Up’ season.

During di BBnaija “Level Up” season Ilebaye chop eviction commot for Biggie house for week three.

On Sunday, she become di youngest winner for BBNaija history as she win 120 million naira worth of ogbonge prize.

She also be di third female housemate to win di TV reality show, afta Mercy and Phyna

During her interview before she enta di “All star” season, she tok say she dey “destined to win di money” and explain say she no win di “Level Up” season because she bin dey naïve.

“I no prepare for di last season and I lack management. I just enta di house as a naïve girl. Dis time I go participate in task, party and socialise.” She bin tok.

‘BBNaija dey give platform’

BBNaija reality TV show, na platform wey dey showcase participants and dia talents during di show.

Despite argument about di relevance or not of di show, past winners and even former housemates don go on to become ogbonge influencers and successes for different works of life as a result of di platform di show give dem.

Past winners of di show include: Katung Aduwak wey win di first season for 2006, Micheal Efe Ejeba, Miracle Igbokwe, Mercy Eke, Olamilekan Agbeleshe, wey pipo sabi as Laycon, Hazel Oyeze Onou wey pipo sabi as WhiteMoney, while Ijeoma Josephina Otabor wey pipo sabi as Phyna win di season 7 show.

Source