Ernest Asuzu biography: Nollywood actor Ernest Asuzu popular movies before death

Nollywood actor Ernest Asuzu na popular face for Nigerian home video, musician, producer, director and television personality wey dey popularly known as ‘El Cream’.

Ernest Asuzu dey popular for playing criminal, hitmen roles for Nollywood movies.

Di Nollywood actor enta limelight afta im act for one blockbuster movie “Another campus queen” in di 90s.

Asuzu die on Tuesday afta e bin just faint all of a sudden, according to di president of di Actors Guild of Nigeria, Emeka Rollas.

[Nollywood actor Ernest Asuzu] – Which movies e don act?

Tori be say Ernest Asuzu. di Nollywood actor wey blow for di 90s doon act in ova one hundred feems dem.

Dis na Ernest Asuzu popular movies before im death:

Royal War

Royal War comot for 2009 and im [Ernest Azuzu] bin act di movie with Ini Edo, Van Vicker and Enebeli Elebuwa.

Im character name for di feem na Ugonna.

Ogidan

Dis 2004 action flick cause Ernest to act with Alex Usifo Omiagbo, fellow Nollywood badboy, Hanks Anuku, Lilian Bach and Jide Kosoko.

E bin even get part two wey drop dat year.

Burning Desire

Di movie drop for 2007 and na Dickson Iroegbu direct am.

Ernest Asuzu follow act di feem wit Richard Mofe Samijo, Mike Ezoronye and Stella Damscus.

Never End

Pete Edochie and Justice Esiri na dem follow act for dis 2005 thriller wey Ifeanyi Onyeabor direct

Broad Daylight

Dis 2001 Teco Benson directed action feem wey Ernest Asuzu act bin also feature actors like Hanks Anuku, Enebeli Elebuwa and Bimbo Manuel.

Last Wedding

Di movie land for 2004 and feature actors such as Ramsey Nouah, Joke Silva and Rita Dominic wit Ernest Asuzu.

Living Abroad

Ernest Asuzu act for di 2004 feem bin get Elivs Chuks as Director and Emeka Enyiocha, Zulu Adigwe and Anne Njemanze

Power of Trust

Di drama feem wey im [Ernest Asuzu] act for di part one and two bin also feature Desmond Elliot and Ashley Nwosu .

My Guy

My guy bin come out for 1999 and feature actors like Rita Dominic for inside.

Accidental Discharge

Di Teco Benason directed 2003 drama feature Rita Dominic , Hanks Anuku , and Robert Peters.

[Nollywood actor Ernest Asuzu] – Background

Ernest Azuzu die at age 37, according to multiple sources.

Late Azuzu latest work na one music Album wey im release for November 2020 wey im title “The truth”.

He launch di music album, wey be 7-track album for December 2020.

Although im grow up Lagos State South West of Nigeria, Ernest hail from Imo State form di Southern part of di kontri.

Before im death, Asuzu tell some local tori for December 2020 say im problem dey spiritual and say im dey plan a return to Nollywood and music after years of no show.

Ernest Azuzu wife, Jennifer Asuzu, na for 2010, e marry her but e neva clear weda dem get pikin or not.

For 2015, tori land say im bin get stroke and according to many sources im recover fine.

E bin enta di news for 2016 on top fake death mata, and e enta Facebook dat time for social media to clear di air.

Now, sadly but true true, Ernest Azuzu AKA ‘El Cream’ don die.