Farouk Lawan jailed: [Prison for Mr. Integrity inside Kuje] What next?

Farouk Lawan wey be once upon a time be Mr. Integrity don collect cell for Kuje prison.

Court convict di former influential Nigerian parliamentarian sevenyears for prison.

Abuja high court on Tuesday find am guilty for bribery wey happun for 2012.

A source close to Farouk tell BBC say di former lawmaker don already dey Kuje prison.

Dis jail yard dey for Nigerian capital Abuja but dat dem go still fight di judgement.

“Dis judgement no sweet us for bele and we no go allow am like dat.

“We go fight am by all di legal means available.” Dis na wetin di source yan.

Dis na why BBC contact professor of law Usman Zannuraini to explain Lawan chances.

So what next for di Kano state (northern Nigeria) born politician get to regain freedom?

“So regarding Farouk issue, dis one na judgement wey high court make.

“E still get chance to appeal up to supreme court level.” Prof. Zannuraini tok.

“But if supreme court decide to uphold wetin dis high court rule.

“Then e means no way out for him and e must serve di prison term.” Di law expert add.

"Farouk Lawan jailed": [Prison for Mr. Integrity inside Kuje] What next?

BBC
Farouk Lawan

Who be Farouk Lawal [Mr. Integrity] and why e popular?

Dem born Lawan for 1962 and e dey married with five children.

Farouk even as a lecturer for Kano state polytechnic in di 90s dey popular.

Na pesin wey dey involved in union mata wella.

Wene join politics and enter house of reps in 1999 im popularity come increase.

Farouk serve till im fourth term for Nigeria house of parliament after 2011 elections.

At dat tme many pipo for im state don dey even call on am to run for Kano govnor.

Political analyst for Kano Abu Isa tell BBC about Farouk

“Na im be shining light as far as northerners dey for house of reps, e dey smart, vocal.

“And many (me too) ask am to run for Kano govnor by 2015 before dis case happun.”

Di 2012 bribery incident na wen Farouk as chairman of di fuel subsidy committee.

Him wey dey investigate corruption case come get ansa.

And e really reduce im politics and im standing.

Farouk Lawan jailed: Times high profile Nigerian politicians go jail

Bala Ngilari

Bala Ngilari be former govnor of Adamawa state wey chop five years imprisonment.

EFCC charge am say im no follow law wey guide how to give contract wen e be govnor.

EFCC charge Ngilari and two oda pipo to court say dem give contract of N167 million.

Dem say e no follow di rule goment put for how to give contract.

Court for Yola agree say di former govnor guilty and knack am five years for prison.

But appeal court for di state later comot Ngilari for prison.

Di appeal court say di charges wey EFCC take put Ngilari for prison no get merit.

And proof say di former govnor break di laws.

Jolly Nyame

Di former govnor of Taraba state dey cool im back for jail where im go spend 14 years.

Na after court find am guilty of mago-mago.

EFCC accuse di govnor say im do mago-mago as govnor between 1999 to 2007.

Justice Adebukola Banjoko say EFCC, under Magu, provide plenty evidence.

Di show say di former govnor tiff N1.64bn.

Di Appeal court and Supreme court also agree with di judgment.

Dem rule say make di former govnor for prison dey chill.

Joshua Dariye

For 2007, EFCC charge Joshua Dariye, di former govnor of Plateau state for money laundering.

Dem say im tiff N1.126bn from di Plateau goment ecological moni.

Nigeria anti-corruption police say im tiff di moni through Ebenezer Reitner Ventures, company.

And di company no even get registration number, according to di court ruling.

After ten years, Justice Banjoko nack am 16 years imprisonment.

Di judge say make im spend two years for one offence.

And anoda 14 years for anoda offense. But im go do di prison at di same time.

Dariye later manage reduce di time to ten years.

Eh happun after court of appeal for Abuja commot four years for di prison time.

"Farouk Lawan jailed": [Prison for Mr. Integrity inside Kuje] What next?

BBC
Kalu na member of President Muhammadu Buhari’s All Progressives Congress

Orji Uzor Kalu

Orji Kalu wey be senator wen court send am go prison enter gbege wit EFCC.

Dem bin accuse am say im tiff N7.65 billion wit im former commissioner of Finance.

Justice Mohammed Idris on December 5, 2019 sentence Kalu to 12 years in prison.

But di supreme court later release am.

Supreme court reason say:

Justice Idris wey jail Kalu, don already be appeal court judge wen e pass judgment.

Now, Kalu dey go back to court to answer EFCC accuse if im tiff di money or not.