Kebbi State news: FGC Birnin Yauri Kebbi State kidnapping – Nigerian army rescue some

At least 58 students of Federal Government College, Yauri Kebbi State still dey miss afta gunmen kidnap dem on Thursday.

Na one state goment official bin confam give BBC.

Reports on Friday say Nigerian Army don rescue some of di FGC Yauri students.

Muhammad Bello wey dey represent Yauri for National Assembly confam di tori to BBC.

Bello say di rescue happun for Thursday night afta gunmen abduct dozens of di students from di boarding school earlier dat day.

“Wetin happun be say soldiers ambush dem as dem dey waka inside bush with di students.

“And afta exchange of fire wey kill many of dem, dem rescue some students.”

On Thursday gunmen attack di school and carry students and teachers go.

Although security officials say dem don rescue nine students.

Kebbi State news: FGC Birnin Yauri Kebbi State kidnapping - Nigerian army rescue some

Getty Images
Empty classroom for school wey dey northern Nigeria

For neighbouring Niger State, more dan 130 koranic school children na im jaguda pipo kidnap last month and dem still dey miss.

And for nearby Kaduna, parents of di university students wey be victim of kidnapping two months ago say dem pay big money as ransom to buy di freedom of dia children.

Di west African kontri don experience plenty school kidnapping attacks from late 2020, as no less dan 1000 students don become victims.

Just on Thursday, di Nigeria president Muhammadu Buhari visit Borno state, wia e commend di army for di ogbonge work dem dey do to reduce to protect citizens from terrorist attacks.

Dis year alone, dis na di number five high profile kidnapping case for northwest Nigeria wey dey face dia biggest security issue in recent years.