Big Brother Naija Season 5 housemates host na Ebuka Obi-Uchendu – See interesting tins to know about di Nigerian lawyer wey go host di 2020 contestants of di television reality show

Ebuka Obi-Uchendu go host Big Brother Naija Season 5 housemates for di fourth year in a row.

Yes, di top Nigerian TV presenter wey get plenti fans especially wit women, get some cool tins about am wey some pipo fit no know.

Ebuka na product of Big Brother realty TV series

Ebuka Obi-Uchendu na former housemate of di Big Brother Naija

show back for 2006 and na him don host di last three seasons wey be See Gobbe, Double Wahala and Pepper Dem.

Ebuka Obi-Uchendu father-in-law na billionaire

Ebuka bin marry Cynthia Obianodo, di daughter of billionaire business man, Chief Vincent Obianodo for 2016.

Chief Obianodo, wey be di CEO of The Young Shall Grow transport empire, na one of di big names for transportation business for Nigeria.

Im pass Common Entrance Exam from just primary four

Ebuka bin write and pass Common Entrance Examination, two years ahead of im mates wen im bin dey primary four.

Dis na exam wey pikin dem for Nigeria dey normally write for primary six before dem go fit enta federal secondary schools.

Ebuka Obi-Uchendu na full fledge lawyer

Most pipo tink say na only TV presenting di show host sabi but dat no be di only professional hat wey im dey wear. Shocker to many, im also be lawyer.

Afta im first degree for University of Abuja, im go Nigerian Law School for Bwari, Abuja.

Den for 2010, im further im education reach Masters level for Washington College of Law for America.

Media personality under 40

Chukwuebuka Obi-Uchendu na ogbonge media personality from Okija in Anambra State, south east Nigeria and dem born am 14 July 1982 for Benin City, southern part of di kontri.

Apart from hosting Big Brother Naija, many sabi am for hosting Rubbin’ Minds talk show on Channels TV (one private national television station in Nigeria).

Ebuka dey also co-host The Spot and Men’s Corner on Ebonylife Television (anoda private national television station in Nigeria).